By NELSON DAFE
Rarara wey be say na big name for Hausa music wey dey sing president Muhammadu Buhari praise well well for songs don change level o. Di musician wey dem know well well for North and wey dey praise many North politicians don bring song come out they yab Buhari for di many tins wey he feel say di president no dey do well.
Di song so feature other popular Hausa singa dem and since e come out so,na so so tok people dey tok about am and dem come dey wonda say abi Rarara no dey Buhari side again.
Early last year,Rarara bin ask Naija pipu say make dem silupport am wit 1k each make e take bring new albulm come out wey go tok about di good tins wey Buhari govment don do.
Eva sins,Naija pipul dey wait for di albulm as dem hia say many pipul donate moni wey reach millions for di albulm.
So pipul come dey suprise now say insted of to praise Buhari, Rarara song now come dey paro for Buhari govment because of insecurity wey dey Naija.
According to pipul wey don hia di song,di singa vex for Buhari say e no no fulfill di promise wey im make about security for Naija.
One part of di song say: "only few pipul dey reazin with you now, sucurity no dey both for city and village dem. Wetin bin start as rumor don be true now. Our wish na to see say tins dey go well again."