
Rapper Ricky Rick wey kpai imsel
One rapper wey dem.no well well don kpai imsef. Im name na Ricky Rick and na South Africa pesin im be.
Police pipul tok say Ricky Rick, wey be say na 34 yias im dey, kee imsef for one small town nia Johannesburg city.
Im real name na Rikhado Muziwendlovu Makhado, and dem tok say im hang imsef wit rope afta im don go tru stress for some time.
Di tori be say e frends see di rapper for im haus by 8:30 for monin and before dem cari am reech hospita e don kpeme.
Pipu no di guy wella for music and fashon for South Africa.
Pipul bin like as Ricky Rick dey dress well well and na so dem.still like as e dey hep yong musishan wey dey come up.
Na im get Cotton club label and Cotton music festiva.
Si way im come dey rite for Twitter before e kee imsef so,show say die dey come for im side.
For im last yan for Twitter Ricky Rick tok say: “I go come back again and. I go dey strong pass as I dey now. Dis one na stee my land.”























.webp&w=256&q=75)



NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.