My broda, make I tell una, any day wey you wake up in di morning, e good make you kneel down tank your God. I sabi say if no be Olorun, man pikin for don peme tey tey.
Di only troublem wey I get be say, dis my taxi driver work wan finish me. By di time I reach house every day for night, di kind tire wey man pikin dey tire no dey for book. If I tell una how many kilokiter my guonguoro dey cover everyday, hmm, una go bow for me.
For rain o, for sun o, na di same ten and ten pence. Dat's why, wen I reach house, to kneel down pray, na wahala. But I tank God say my wife na real prayer warrior. If Bose pray for you here, you go just begin dey cry. You go tink say na today, today Amagedon wan shele. And my two pikin dem - Bisi and Funke - don dey pray like dia mama. Na di only insurance wey I get be dat. If no be so, all dis ogbologbo jaguda dem wey full for Lagos roads for don take me do pepper soup tipe tipe.
Na so I carry one passenger yesterday for dat Ojuelegba Round About. Di madam size na extra large. As di woman enter di back seat of my guonguoro, my shock absorber just suffocate one time. Di woman say make I drop am for Ketu, I tell am say im money na N3,000. Di madam sabi di kind weight wey e carry, so e no just argue. E pay me cash one time. As we dey go for road, e say wen we reach Obanikoro bus stop, make I stop carry im husband. I tell am say I no dey do so, I tell am say dat drop na drop, no be danfo or BRT I dey drive wey I go dey stop per second, per second for every bus stop wey dey for road. Di woman begin beg me. E say e go add small money join am. Na wetin man go do? Na so I take style gree.
Di man for Obanikoro bus stop na one kind person like dat. Di bobo slim no be small. Na di real opposite of im wife. I come talk am for my mind say na only God go save all dis tiny man dem wey dey carry over-size. My two passenger dem just be like elephant versus ant. But di ting wey surprise me be say di man come enter front seat wen im Dunlop Elite wife siddon for back seat.
As I drive dey go, di bobo open im bag, bring out 3 orange. E take one, give im wife one, den give me one. I tell am tank you. E say make I take am. I collect am keep. I come use corner eye see say di two both of dem never begin lick dia own orange. Dem dey wait for me make I begin lick my own first. Small time, di madam ask me weda make im husband helep me peel my orange for me as e be say I dey drive. I tell am say make e no worry, say I go lick am after later.
I come dey wonder why dis people just dey by force me make I lick di orange wen dem dey take style dodge to lick dia own. Small time di bobo look back, di madam give am sign. Me I understand dat kind sign well well. Na gbomo gbomo sign. Dem no know say I dey look dem for mirror. Emi ke, me wey be original Man About Town, aka Oga MAT, di Prince of Ogbomoso land!
Di woman put hand for im hand bag, wan bring out someting, but as e see say we don reach Maryland bus stop wey Olopa dem tanda, e no gree bring out di ting again. Na dat time everyting come clear for my eye. Na im I march break fiaam, I park. Before dem know wetin dey happen, I don call Olopa for dem. As dem search dis my two passenger, come see orisirisi ting dem wey dey for inside dia bag and for dia body – juju o, gun o, knife o, and all dose bad ting wey dem dey take do people gbomo gbomo.
Na so I lef dem for Olopa hand, enter my guonguoro begin dey go. If Olopa like, make dem collect bail for dia hand and lef dem for road dia, na dem sabi.
I look time, na exactly 8 o’clock pm in di night. I just begin face Abule Egba wey I dey live. Na so dem for just kidnap man pikin o. But tank God for Bose and my two woman pikin dia prayer everyday.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.