NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Lagos na wa. Since di first day of dis month, Lagos don come sweet like no man business. All dough while some people dey enjoy, some dey cry. Some dey suffer, some dey smile.
Na we taxi and danfo driver dey enjoy pass since wen Oga Sanwo-Olu trowey okada and keke Marwa dem comot for Lagos road.
Now I no dey carry passenger go long distance again. Na only within Ikeja wey our garage dey, na im I dey operate. We taxi driver no even fit carry di passenger wey dey ground finish for Ikeja, talkless to go far.
Na so people dey full for road like sand sand, dey wait for motor wey go carry dem. If any taxi or danfo jus show face, come see rush. And any amount we mention, passenger dem ready to pay.
Some go wait for bus stop tire sote dem go begin use leg waka dey go.
And na so e be everyday -morning, afternoon and night.
Di ting be say, if one person own no spoil, anoder person own no go better. Abi I lie?
Nowkabukabu sef don come out. All di Baba dem wey don retire tipe tipe for gofmen work, don put dia motor for road dey carry passenger. Even Yahoo Boys dem don put dia fine fine motor sef for road, dey follow hustle.
Now, all our union member dem dey report for Madam Shine buka every evening wen we close for work.
We don even draw time table- each day one member go sponsor all di drink and pepper soup wey all our union member consume.
Na Emeka first start. After dat na our branch chairman Jimoh, den Akpan before I follow last week.
Idowu, our branch Treasurer nearly finish me for my turn. Idowu lef di Monkey Tail wey be im brand, come dey drink Odekun and chop like 4 fresh fish pepper soup for my nake because e don see awoof.
Na im make, on Monday wey be Idowu turn to sponsor, I prepare for am well well. I nearly finish 5 fresh fish pepper soup and use 5 bottle of "My Usual" wash am down.
But di ting show me pepper di next day wey be Tuesday. I no know wetin make Madam Shine use dat kind plenty pepper for pepper soup dat day.
Di ting turture me tire for road. E first come like mess wen I carry one passenger for drop go Airport Road. I first use style bend one side of mynyansh andrelease am ffiiaaa, my passenger no hear. Tank God say di ting no too smell.
As di ting come again, I wan do di same ting but I realise say , if I try am, na di big one go jus come out - Igbe! I hold am back.
But di ting come back with full force. Na im I clear my guonguro for roadside. I tell my passenger make e give me one minute. Na so I run enter dat small bush wey dey near Airforce Base. I spend like 20 minute dey release, di ting no wan stop. And na so my nyansh dey pepper me like fire. Tori Olorun!
Wen I mange come out, my passenger don vex tire. I beg am say I no know wetin I chop for night wey dey run my belle.
We jus move small, di ting come again. And no bush dey for dis place. And small go slow come dey for road. I tie my nyansh, but di ting wan come out by force by fire. I come begin sweat like xmas goat.
Wen we jus manage reach wia Mr Bigg's dey, I branch, park and jump out of my guoguoro and rush inside Mr Bigg's. As I reach di toilet, dem don lock di door. Olorun Oba o!
I hold my shokoto trouser for one hand, use di order hand hold my nyansh make di ting no drop. I run go meet di manager for counter. Wen di manager see my condition, e no kukuma ask me any question, e jus bring out di key and give me. Come see di kindspeed wey I rush enter di toilet!
Wen I come out after like 25 minute, all my body don weak.I tank di manager well well as I return di key.
By di time I go back to my guoguoro, my passenger don vex go, na so I begin dey rush back to our garage.
Before I reach garage, I don release like 4 times again for roadside.
Wen I finally land for garage, I run go chemist wey dey di next street. I tell di man everyting wey happen. Di man mix capsule and all di orisirisi tablet for me. Na for im shop I use pure water swallow all di medine.
As I pay am money wan begin dey go, di man say,
"Oga MAT, make una take am easy dey chop di awoof money wey una taxi and danfo driver dem don dey make since wen Oga Sanwo-Olu pursue okada and keke Marwa comot for Lagos road o. Remember say awoof no get bone, e dey run belle."
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much again.