NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
No passenger go fit drag me comot for dis Lagos again lai lai, no matter how much dey involve.
Di ting wey I take my mouth see for weekend, my eye no fit talk am, all becos I dey find big money. And at di end of di day, shi shi no come dey my hand. Na order people come chop di hole money.
Na Friday evening one bobo like dat come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Di bobo talk say im old papa wey visit am for Lagos dey sick. E say e wan make better taxi driver carry im junior broda, im sister plus including im sick papa, go drop for dia village for Akwa Ibom.
“Akwa Ibom?” I no know di time dat question fallcomot for my mouth.
“Yes nah, Akwa Ibom” Di bobo sef answer me.
I tell am say, no be say I dey fear to go Akwa Ibom, but I tink say e for pay am pass if e use taxi driver wey come from dat side. I tell am say one of our union member for our garage na Akwa Ibom man by name Akpan.
Di bobo tell me say no be say im no sabi plenty taxi driver dem for Lagos wey come from dat side, but na me, Oga MAT, all di people wey im discuss with tell am make e charter.
I say no troublem, dat I ready for am. But I use my language tell am say, “Obe t’odun, owo lopa.”Di bobo ask me wetin e mean. I tell am say di meaning na, soup wey sweet na money kill am.
Na dat time di bobo come tell me say if na money matter, make I no worry. E say e for don go airport go charter flight for im sick papa, but di old man don warn all im pikin dem say make dem no ever put am inside plane becos afraid na imgo kill am even before di plane took off.
Di bobo come point hand for di car wey im carry come meet me for our garage.My people, If una see dis bobo car, na heaven wey dey for earth! Na correct Jeep with bullet proof. Tori Olorun!
Di bobo come talk say im work no give am chance wey im for use im jeep drive im papa go back village, dat’s why e find me come as people tell am say na me be di best Lagos taxi driver.
E ask me how much I go take, I mention one kind amount so dat di bobo go begin price. But dis bobo jus gree one time. I talk am for my mind say Olorun don butter my bread today be dat.
Before I close my eye and open, di bobo don count all di money pay me. Olorun Oba o!
E give me im house address, say make I come first ting for morning di next day (Saturday) come carry im papa, im sister and junior broda go drop for Akwa Ibom. I tell am say “Your wish is my commander!”
Wen I reach house dat night, I tell my family about di contract. I give my wife Bose enough money to take care of di family till I come back.
Saturday morning, I don land for di bobo house for Omole Estate wey dey for Ojodu Berger. Na so I carry im papa, im sister and im junior broda.
We don dey blow dey go Akwa Ibom be dat with my guonguoro.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.