NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Di way tings dey go for dis our contry now, I no sure say dis my taxi driver work go take me far.
See di order day wen Dangote wan employ trailer driver dem, I tell my first woman pikin, Bisi make e helep me write application make I carry go give dem.
I say if na experience, I dey kampe. Se, to learn mecho work finish, den come dey drive taxi for Lagos since before di war, na small ting?
As I drive my guonguoro dey go for Dangote office for Ikoyi, I dey smile. I talk am for my mind say no how, no how, dem must to take me. I even dey target Chief Driver position.
Wen I reach, come see di place be like market, and na small small pikin dem full dia. I sure say di person wey old pass for all of dem patapata na 25. Boy o, girl o, all full for dia. And all of dem na young graduate dem be. See as e come be like say na me be great grandpa for all of dem.
I come talk am for my mind say, graduate ko, se na paper we go chop? Dis one na practical, no be wetin you go learn for university. Me, my driver license na di one wey I fit take drive caterpillar sef.
I dey too sure say na me go be number one wey dem go take dat day. I don even begin dey plan for di money wey Dangote go dey pay me every month as chief trailer driver of di company.
As we dey wait, people still dey come. And all of dem wear suit and tie. Na my shokoto trouser and jumper I wear. Abi na suit dem dey wear drive trailer?
Small time, we don nearly come plenty pass sand sand wey dey for Bar Beach. Tori Olorun!
Wen time nack 12 o’clock pm in di afternoon, na im one lepa shandy sisi carry file come out. E waka with one bobo wey im bele big like woman wey don nearly born. As di two both of dem jus show face, everywia come quiet like graveyard.
Dem come talk say di company wan employ 20 people wey go drive company trailer. Dem tell us make we go one corner go drop our application letter. Wen everybody don drop application finish, my brother, di heap come tall pass Mount Kilimanjaro sef. Olorun Oba o!
Na im dem come announce say make we go and come back di next day so dat dem go fit go trough all di application, one by one.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.