Philo, di national president of ashewo association come tell im second for inside my guonguoro say for dat meeting wey dem dey go so for Shogunle, make e jus dey support everyting wey e go talk as president.
E say im dey vex becos e too much for dis gofment body.
E say first, gofment close down all di night club wey dey for Lagos, in di name of Coro. Di next ting be say gofment come do curfew. All dis ting come make dia customer no dey show face again.
As if dat one never do, gofment don come ban Twitter wey dem dey take do marketing online. Tori Olorun!
Di ashewo president come talk say, e no know wetin ashewo do dis gofment wey make di gofment wan push dem comot for business, wen dem know well well say work no dey.
Na im make e talk say, for dat ashewo general meeting wey dem dey go so for Shogunle, dem must to decide say all ashewo for Naija must protest on June 12 nationwide.
E say if dem go on strike, all dose big oga for gofment go come beg dem becos na dem be dia customernumber one.
E say for night, na so all dose big man dem go come carry dem go nack TDB. E say na for night club dem dey see big man dem pass. Dem go carry dem after club, go for hotel go nack dem ti-ti-ti-ti, day go break.
E say but di big man dem dey drop better pay, no be like all dose olopa wey dey come harrass dem, pack dem go for dia station and begin nack dem for free, and still collect money for bail.
E say but wetin dem no come understand be say, why dia big customer dem come be di same people wey one spoil dia market.
E say na im make all di ashewo must protest on June 12 wey be democracy day. And e say e go be naked protest. All dia member go protest naked - no bra and no dross, so dat gofment go know say dem serious. And dem go use iron bar lock dia door for night make all dose customer no go fit enter for short time.
As we reach for wia dem dey go for Shogunle, come see dia member don full everywia.
Wen my two passenger come down, now so all dia member dey hail "Presido! Presido!! Presido!!!"
I come talk am for my mind say na wa o, ashewo too wan protest dia own insecurity!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.