Noting wey di son of man no go hear in di curse (Olorumaje) of dis our taxi driver work.
Una kukuma sabi say na orisirisi passenger dem we dey carry – di good, di bad and di OBJ... sorry, ugly na im I wan talk o. Na sleep of di tongue. No worry, I go pour di tongue water make e wake up before e put me for troublem.
Na so I go drop one passenger for Orile Agege yesterday. As I drop am say make I dey go back to our garage wey dey near Ikeja under, na im two sisi dem stop me for Capitol Road.
As I jus see di two sisi, I know sharp sharp say dem be ashewo. E no hard to know dem nau. How dem dress go jus tell you who dem be. Dem no dey hide am.
Me, I no dey always wan carry ashewo becos of dia wahala. If you carry any ashewo for night na dat one bad pass. Di ashi go make sure say e no pay your money in cash but in kind. E go work on your kini as you dey drive till you no go know wen you begin dey call am Honey. Abeg no ask me weda or wedan’t I dey talk from experience becos I no get answer.
As I match break fiiaaaaam, one of di two sisi come near my window, e say dem dey go Shogunle. Dem no even wait make I say yes or no, dem don open door enter. Di two both of dem enter for back.
I tell dem my price, dem gree. I say make dem pay, dem ask me weda my own taxi na cash and carry. I tell dem yes. I say my work and dia own na broder and sister. As dia own be cash and carry, na so we sef don follow dey do cash and carry. Na so one of dem open im hand bag, bring out money and pay me.
I match trottle make we begin dey go, na so dis two sisi begin nack tori.
From wetin dem discuss, I come know say di one wey comot money pay me na di national president of ashewo association of Nigeria but dem give dia association sweet name - National Association of Commercial Sex Workers of Nigeria, NACSWN.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.