No be everybody wey dey open teeth for you be your friend.
Enemy full everywia – for road, house, market, church, mosque, school, office, shop, even for dis our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Now, as passenger dem no too dey for Lagos becos of all dis Uber, Bolt, BRT and all di orisirisi transport wey don come full everywia, if I see interstate passenger, I dey carry. Na dat one sef pay pass.
Una kukuma know say people don dey underrate our yellow taxi. Place wey we dey carry N2,000 for drop teletele, now you go see passenger begin price you like say you dey sell pepper for Agege market.
Na im make my eye dey well well now for interstate. Plenty people wey get car, no get driver. Dem be “I go drive mysef.” Anoder ting be say no be everybody sabi drive for expressway. And dem no wan enter public motor. Na im make dose kind people dey come our garage come take us travel go Ijebu Ode, Benin, Kwara, Kogi, Abuja, Kaduna, Onitsha, Owerri, Aba, Umuahia, Uyo, Calabar, Port Harcourt, etc etc.
If na wen contry good, I dey even carry passenger go drop for Katsina, Borno and Sokoto, with dis my guonguoro o.
But I no fit try am now becos of ungun known men, sorry... gunknown unmen, sorry...knowngun unmen. Abeg, I don tire. Sha, una sabi di people I mean.
I no fit try am again lai lai! Na only Lagos I dey operate now. Any day I see passenger carry, I take am. Any day I no see,, I also take am like dat. Abi?
But I shock yesterday wen our Union member, Emeka tell me say e dey go drop passenger for Dopemu and e go wan see me wen e come back for garage.
I tell am say no troublem, make e go come as Dopemu no too far. But I tell am say if passenger show face, me sef go carry di passenger o.
And true, true, Emeka no tey. E comot for garage around 9 o'clock a.m. in di morning, before 10 sef e don come back. E talk say road clear, well well, no Go-slow.
Emeka come tell me say, e get one contract wey e get and e wan pass am give me. I ask am which kind contract be dat, and which day e begin like me sote e wan pass im contract give me.
Emeka say di contract na to carry passenger. E say dem be four bobo, and na interstate, but im no trust im own taxi say e fit go come back.
I tell Emeka say no wahala, so far di money dey good. After all, our business na to carry passenger.
I come ask Emeka which day dem wan go, e say na dat same yesterday night, becos dem wan arrive wia dem dey go today (Tuesday) morning.
I ask Emeka which state dem dey go, e say na Biafraland. Tori Olorun!
I come remember say dat yesterday na 31st May. Biafra people say na sit-at-home for everybody. But soja and olopa dem say na lai. And oga patapata don kukuma give order say make dem soja and olopa shoot at sight.
I come talk am for my mind say, so Emeka wan make I carry im broda dem go for war front?
I tell Emeka say make e carry im blood contract and blood money go fall inside lagoon. I no wan. Period!
I tell am say, from dat yesterday, I don mark am as my enemy number one.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.