Yeye question don jam yeye answer

News Express |28th May 2021 | 1,077
Yeye question don jam yeye answer



Di kind tings wey man dey see and hear for dis Lagos, I no sure say e dey happen for order parts of di contry.

For Lagos, everybody dey do I too sabi and notice me. Everybody dey wan show say im be master.

See small belle wey pain me di order day. I close quick dat day for our garage wey dey near Ikeja under bridge, say make I run go one medicine store wey I dey always see for our street for Abule Egba.

I never enter dat chemist before becos even as I don dagba finish, I still dey kamkpe. My body still strong kakaraka. But I no come know wetin make my belle pain me dat day sote e come give me small headache.

As I enter di medicine store, come see plenty people wey come to buy medicine and plenty na sisi dem. We plenty sote we come dey for queue.

Di bobo wey get di medicine shop na one kind tiny man like dat. In fact, wen I first see am, na el-Rufai jus come my mind.

But di bobo voice pass loudspeaker wey dey for moshalashi.

Tell am say you wan buy medicine, e go ask you wetin dey do you and why you wan buy dat particular medicine. Wen you tell am finish, e go say e sabi di sickness wey dey worry you and e get better medicine wey go cure you.

Even if na doctor give you paper for hospital to take go buy dat medicine, na di same ting dis bobo go tell you. I come talk am for my mind say shey dis tiny bobo na doctor abi na chemist, or na di two both of dem?

Any sisi wey tell am say e get as e dey do am for body, e go first carry di sisi go inside im inner chamber for exam. Chaaii!! Dis bobo go don do touch touch and comot belle tire for dat im shop.

Wen e reach my turn, I tell am say my belle dey pain me and I get small headache.

Di bobo first look my face ti-ti-ti-ti. After, e come ask me weda I dey chop well. I tell am yes. E say which kind food. I tell am say eba with egusi soup but I like amala with ewedu pass, even dough na pounded yam with efo riro I like pass.

Di bobo come say you see am? E say how can old Baba like me dey pack carbo...carbo wetin sef...carbohy... yes carbohydrate, pack full my belle every morning, afternoon and night and I go talk say I dey chop well? E say how belle no go dey pain me? And na shout e dey shout am o. See as everybody come dey look me. Tori Olorun!

Den e come ask me how my libido dey. I ask am wetin come be libido again? E say how my kini dey, weda I dey sabi perform well well. Shiooorr!

I come ask am wetin concern belle wey dey pain me and weda or wedan't my kini dey perform?

Di bobo say weda I wan teach am im work. E say e know wetin im dey ask me, say e wan find out wetin really dey worry me so dat e go give me better medicine wey go cure am one time.

E come ask me again like loudspeaker weda I sure say dis kind food wey I dey chop so no dey affect my libido. Olorun Oba o!

Na dat time I come ready to answer am as Man About Town and original garage Baba. I tell am say di only wey e go know weda my libido still dey, make e send im wife come sleep for my house till tomorrow morning, wen di wife come back, e go give am di answer.

Come see as all di people wey dey for inside im shop come dey laugh, and laugh, and laugh!

Na so I waka comot for di yeye man shop, go take my original agbo wey dey for under my bed. In di morning, I bounce back to work with my guonguoro. Yeye orange!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 4:55 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025