See me, see woman trailer

News Express |21st May 2021 | 1,059
See me, see woman trailer



If anybody swear for you say make trailer jam you, beg di person to tell you which kind trailer e mean.

Di ting be say, if motor trailer jam person, atlist dem go fit rush am go for emergency ward. And if di person get luck, e survive.

But if woman trailer jam sombori, hmm, di person own don finish be dat o - weda or wedan't na for bed abi na for road di jam take place.

See like di order day, I comot for house around 9 o'clock a.m in di morning begin dey go our garage wey dey near Ikeja under bridge.

As I reach Moshalashi Alhaja for Agege, na im one trailer, sorry madam, stop me.

I jus say make I stop, but for my mind I know say I no fit take di risk carry am for dis my guonguoro wey I dey manage so. I know say if I tell am high price, e no go gree pay.

As I match break fiiaaaaam, di madam come near, e say make I carry am for drop go Obalende. I tell one high price like dat, e say e go pay. I increase di price, e say e go pay. I increase di price again, di madam still gree to pay. Olorun Oba o!

Afraid come ask me. Na wetin I go come do nau. I sure say di madam go don tanda for dia tipe tipe, no taxi gree stop carry am. Na wetin make me stop?

If you see dis madam, afraid must to catch you. E jus resemble dat bobo wey dey advertise Michelin tyre for television. And im nyansh come be extra, extra large. I sure say na special tailor go dey sew all im dross becos im size no fit dey for market.

Di madam ready to pay any amount, which excuse I go take discharge am now?

Na so I come down, go open back door for am. To enter di motor sef hard am. E first put one leg inside, put im head, den tell me make I helep push im nyansh inside. Dat one na hard labour nau. Tori Olorun!

(To be continued)

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 5:01 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025