Sikiratu give me burantashi for action 

News Express |7th May 2021 | 1,323
Sikiratu give me burantashi for action 



Noting wey di son of man no go see for dis taxi driver work.

Na so I siddon yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge, dey look road weda any passenger go come.

I no sleep well for night as NEPA no gree give us light for my area Abule Egba. E don reach two months now wey we see light last. And person don burn petrol for generator tire. Di petrol wey I dey buy for my guonguoro no reach half of di one I don use for my I-better-pass-my-nebor generator for house since NEPA start dia wahala.

Na im make dat night, I no wan buy petrol again for di generator make I go see money buy di petrol wey I go take work. Come see as heat and mosquito dance konkoma for our body for night. Nobody fit close eye ra-ra-ra.

As I dey look road for garage dat yesterday, na so sleep dey torture me, no be small...

Small time Sikiratu appear.

If you see wetin dis girl wear, hmm, you must to shock. Any man wey see Sikiratu with dat clothe and e no look am, na im be say neck dey pain dat man.

Sikiratu wear one kind wicked mini skirt like dat, and di top come be body hug, e no wear bra. Di two headlamp for im chest come stand like Standard Bank. And e kukuma come dey shake am like Shakespeare make di ting enter my eye. Tori Olorun!

Sikiratu come tell me say e wan take me for charter go one place for Maryland. E say make I no worry, say e go pay me well. I come talk am for my mind say for wia dis buka girl see money?

E come be like say Sikiratu sabi wetin dey my mind, e open im handbag and bring out one bundle of mint N1,000 notes. I choke!

Quick, quick, I jump inside my pilot seat. Sikiratu enter passenger seat for front.

Na so we begin go till we reach one house for Maryland. As I park for car park, Sikiratu say make I follow am come down. Na so di two both of us enter di house. Sikiratu go meet di bobo wey dey for counter. I see as e comot money give di bobo, and di bobo give am paper.

Di bobo carry me and Sikiratu go one room wey only bed dey for inside. I no know say Sikiratu don pay for short time for di two both of us.

Wen di bobo comot for di room, Sikiratu hold me for my waist, look into my eye and say, "My darling Oga MAT, na dis room me and you go stay and enjoy till evening time. No worry, I go pay you for di day. Money dey.”

Before e talk finish sef, e don comot im top trowey for bed, comot di mini skirt. Na dat time I see say Sikiratu no wear dross. Olorun Oba o!

Na so Sikiratu open im handbag and bring out one small bottle, e open am and say make I drink wetin dey for inside. I ask am wetin e be, e say na for action, make I jus drink am. E say e go make me fire well well.

Na so Sikiratu begin remove my shokoto trouser as I dey drink di sometin wey I sure say na burantashi. We fall on top of bed. Sikiratu begin kiss me piom piom piom. Me sef follow kiss am piom, piom, piom. Dat time my kini don dey do like snake head, ready for burantashi action...

Small time I hear person nack me for shoulder and say, “Oga MAT wake up! Shey na sleep you come sleep today for garage? And na so so mouth you dey lick piom piom piom for sleep since.”

I open my eye, see say na our union member Emeka wake me from sleep.

E no go better for NEPA lai lai.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 7:06 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025