As Iyabode mama still chuk hand put for my shokoto trouser, I come beg am say I go marry im pikin, but make e allow me ask am jus one question.
I ask Iyabode say how many months di belle be? E say na four months going to five.
I say fine. I ask am say, apart from dis our garage, weda e don see me for anywia before. E say yes. I ask am wia. E say e don see me for road plenty times wen I dey drive passenger pass for my guonguoro, but me no dey see am.
I ask am which day e don bring im Ewa Agonyi and Agege Bread come sell for us for dis garage last. E say na last year.
I say good. Last year, shey na before, during or after di Coro lockdown? E say na one week before di Coro lockdown e bring im market come sell for our garage.
I say Coro lockdown na March last year, and your belle na four or five months, and me and you never meet outside dis garage before, so how e come be say na me give you belle? JAMB question!
Na so im mama take style comot hand for my shokoto trouser small, small. Di next ting be say di mama give Iyabode one kind dirty slap like dat ppppuuuuaaarrrhhh!!! I sure say di Mobile Buka Girl been see 7 stars dat very time.
Our union chairman, Jimoh come ask Iyabode say, wen dem enter di garage, na Idowu e first point hand. After dat Akpan and finally Oga MAT. Why?
Iyabode say na becos, anytime e bring Ewa Agonyi come sell for garage, Idowu go touch am for nyansh, Akpan go hold im hand, and me I go embreast am.
Iyabode mama come talk say, “See dis yeye pikin o. Na Ewa Agonyi and Agege Bread I tell am make e dey carry for head waka dey sell, now e don go carry belle. And e no come know who give am di belle.”
Di mama begin beg us, dey cry as e carry im pikin dey go.
I come talk am for my mind say, Eledumare no go allow di ting wey make me run comot for my village for Ogbomoso come Lagos, happen again.
I bind and cancel all di Arike and Iyabode for my life!
Abeg helep me say Amin!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.