Di order day, I go drop passenger for Egbeda, come back for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Di kind Go-slow wey dey for dat Egbeda-Ikotun road no be small. Na so I come tire gan.
As I reach garage, I say make I rest small. E no even reach 5 minute, I see Iyabode waka enter garage with one mama like dat.
Di mama no get one eye. I come remember say Iyabode don talk am tele tele say snake been bite im mama for eye wen dem dey for dia village before dem come Lagos. Na im make I sabi say di mama na Iyabode mama.
As di two both of dem jus enter garage, di mama ask Iyabode “Which one?” Iyabode first point hand for our union treasurer, Idowu. Small time e point hand for Akpan. After dat, e look my side and come point hand for me.
Im mama ask am weda e no know who for dis garage give am belle. Na so Iyabode tell im mama say na me, Oga MAT. Shiooorr!
Na so im mama hold me for my shokoto trouser. E begin hala. E say, so na agbalagba like me come give im pikin belle? Na so di mama begin drag me o. E say I must marry im pikin plus di belle today, today. Tori Olorun!
All our union member dem come try to comot dis mama hand for my shokoto, na lai. Olorun Oba o!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.