Madam don finish my guonguoro

News Express |20th Apr 2021 | 1,162
Madam don finish my guonguoro

Abami Eda been don talk am say orisirisi nyansh na im dey. And na true talk.

Some nyansh na Football size, some na Plaza, some na National Stadium. But all of dem na Boysquarter. Dat mean to say, na di quarter wey all di boys (and man dem) dey always like to visit.

And di ting be say, every size get im own weight: Football size na featherweight, Plaza na middle weight, while National Stadium na heavyweight champion.

Any taxi driver wey no know di difference, na im be say e be JJC for dis business.

Na im make e get some woman passenger dem wey I no dey carry even for charter, no matter how much di passenger ready to pay. If any woman stop me, I must to use style see wetin e carry for back. Na di size go decide weda or wedan’t I go carry am. If no be so, my broda, di son of man for dey buy tyre per second, per second.

Di order day, I carry one bobo go drop for Badagry. As I dey come back, I no come see any passenger for road carry. And una kukuma sabi say Badagry no be for here.

I drive sote I pass Okokomaiko, no passenger stop me. Shiooor!

I come talk am for my mind say, so na like dis I go burn my petrol dey go till I reach our garage wey dey near Ikeja under bridge? Na wa o!

I pass LASU gate, enter dat Iba road to begin face Igando. Small time, na im one sisi like dat stop me. Di sisi waka come meet me. I tell am make e enter but di sisi tell me say no be im wan go, say na im mama. I ask am wia im mama dey, e point hand for di house wey dey dat place wey e tanda.

I tell am make e go call im mama come and make e do quick. Di sisi say make I revise come di house.

E say make I no worry, dem go settle me.

I come remember as I don drive empty from Badagry, no passenger. I say well, as di house dey for di road, make I jus go carry di mama.

I put my guonguoro for revise, and drive inside di compound. Di sisi hurry go inside di house. E no tey, I see di sisi and im broda hold one mama for hand dey come outside.

Di sisi say make I open di back door. I come down, turn around to open di door. Na so my eye jus go for di mama back fiaam! Di ting wey I see shock me. I nearly shout!! Dem no tell me say na national stadium I wan carry!!!

I wan run go back to my pilot seat and move, but I come remember say all my four tyre na tear rubber, and I jus service my guonguoro e never tay. I also remember say di sisi promise to settle me well.

I ask wia dem dey go. Di sisi say na Ikeja General Hospital dem dey go. E say im broda no dey follow, na only di two both of dem – imsef and im mama. E sweet me for belle say na my route dem dey go. I tell dem my price, dem gree.

I open di back door for dem. As di mama jus drop im nyansh for di seat, my guonguoro faint. All di four tyre jus go down patapata. Olorun Oba o!

See as I come dey sweat like Xmas goat. Dem carry dia mama out. I run go main road, I see one vulca. I carry am go di compound make e helep me pump di 4 tyre.

As my guonguro jus breath in again, na so I pay di vulca, jump enter my pilot seat, open ignition, start engine, put am for gear one, and move. I no jus look back. Tori Olorun!

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 7:06 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025