How N2000 petrol go finish now, now, now? I wan cry!
I wind up my glass, bring out jerry can for boot, lock all di door and take Okada back to dat petrol station.
Wen I reach dia, I tell di yellow sisi say di petrol wey e sell for me don finish for road wen I no even pass Oshodi Oke.
Di sisi ask me weda I sure say na for dia station I buy di petrol? Na dat time my head come scatter. I wan show am say, even dough I don dagba, na me be di original garage boy for Lagos. I wan show am say after MC Oluomo, na me.
Anoder person wey see me wen I buy di petrol dat time come talk say na dia I buy di petrol and e no reach 10 minute wey I drive comot. E even talk say e hear wen I tell di yellow sisi make e sell N2000 petrol for me. E say N2000 petrol no fit finish like dat unless na abracadabra.
I no know say di man na Oga Olopa wey come buy petrol for im car, but e no wear uniform.
Di oga olopa say make di yellow sisi hand over di pump to am. Di oga olopa check di pump ti-ti-ti-ti. E come say make I put down my jerry can. E operate di pump to put petrol for inside di jerry can. Na so petrol jus dey drop small small like ear drop. Na air di ting pump full inside my jerry can. Olorun Oba o!
So na air dis people dey pump put for people tank say na fuel! No wonder di sisi no happy wen I tell am say I no hold money for fill up again! If na fill up I no for ever know but di money go double.
Na for dat place di Oga Olopa make call, before you open eye sef, olopa dem don full di petrol station, all of dem with gun.
Olopa command di petrol station manager to full my jerry can and also give me back my N2,000.
Na so olopa dem carry di manager go, me sef begin go for wia I park my guonguoro for road.
See as small pikin wan come do me abracadabra for Lagos.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.