Ijebu woman wan take magun finish me

News Express |30th Mar 2021 | 1,461
Ijebu woman wan take magun finish me

My papa don tell me tele tele wen I be small boy for our village for Ogbomoso, before e peme, say di ting wey dey sweet man too much, na im dey kill am. E say woman kini na one of di ting.

Na im make, since I run comot for village come Lagos becos of Arike papa, I dey always remember dat ting wey my papa tell me dat time.

See like last Saturday, one passenger take me for charter go one owambe party like dat for Ijebu Ode.

My passenger say na evening party of dia club, but no be till day break. E say I go wait for am and carry am come back for Lagos any time di party finish.

I tell am say no troublem, so far e pay me, but make e remember say na inter-state service be dat. I tell am my price, e gree.

I suspect say di bobo na big man but e no wan go with im motor. I sure say e dey fear all dis kidnap wey Fulani herdsmen dey do for road now.

We reach Ijebu Ode around 4 O’clock p.m. in di evening.

Come see better car full every wia. I come talk am for my mind say dis one na real big man party o.

And e come be like say everybody carry im wife come di party. But na only my passenger waka come.

As my passenger come down to enter di party hall, I find one corner for di car park and park my guonguoro. But I make sure say I show my passenger wia I park.

I dey inside my guonguoro dey hear everyting wey dey shele for inside di hall. Na so so Apala and Juju music di band dey play. E come be like say na K1 be di live band. Come hear as everybody dey dance, shout, jump and happy. I sure say orisirisi drink and food go don full for dia.

Wen night begin show face, I see say di corner wey I park, light no dey shine for dia.

I dey inside my guonguoro see as one man and woman hold demsef, waka come dat my corner. Dem no know say I dey inside. Dem begin do rob rob for on top of my bonnet.

Small time, di woman don pull down im G-string dross, di man sef comot robe for im shokoto trouser and bring out im kini. Dem don dey nack for on top of my bonnet be dat o, and for my koro koro eye. Tori Olorun!

I fit swear say dat woman na person wife and dat man na person husband.

As dem comot go back to di party hall, one woman come out. As e dey waka sef, you go know say di madam go don finish like one carton of Odekun.

Di woman waka come di dark corner wey I park. E comot im wrapper, e bend down and point im nyansh for my side. I come talk am for my mind say, if I keep quiet, dis madam go empty all im piss for my guonguoro body. Na im I do like say I dey cough. Di madam shock.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:27 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025