Re: I confuse. Shey make I take di vaccine?

News Express |23rd Mar 2021 | 1,261
Re: I confuse. Shey make I take di vaccine?

My people, make una follow me see di kind reply I get since Friday wen I ask weda or wedan’t make I follow take Coro vaccine wen Alausa people come on Monday.

All dis na becos I talk say afraid dey catch me becos of wetin Mutiu tell us for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

My torch light chinko phone battery suffer, no be small. Come see orisirisi message wey dey enter sote my phone quench by force.

Make I jus show una small:

Dear Oga MAT,

So you sabi fear like dis? Ordinary Coro vaccine wey gofmen wan take safe your life, na im you dey listen to dat your amu’gbo union member Mutiu. Anyway sha, all of una taxi driver na di same, na so so ogogoro and wee wee una sabi.

Abosede Ogunnaike

Lagos

Dear Oga MAT,

Please helep me tell all una union member dem for your garage wey dey near Ikeja under bridge say, dat Monday wey Alausa people wan bring dat Coro vaccine come, make all of una disappear patapata. Sebi una tink say Mutiu na igbo and monkey tail dey worry am? But na true e talk. Abi you never see drunkard wey dey see vision?

Mustapha Abdulkareem

Kano

Dear Oga MAT,

You know that I like you, and I no go lie for you. As a doctor who works with gofmen hospital for oyibo land, I don take di Coro vaccine and noting do me. I no even get headache at all. I took di vaccine since January and I still dey kamkpe. Di vaccine na for your own good. Make sure say you, your wife Bose and your two woman pikin dem- Bisi and Funke - follow take am if una no wan catch Coro.

N/B. Abeg make you no laugh my pidgin o. Na di small one wey my Nigerian friend for here teach me be dat.

Dr Stephen Mark

Ireland

Dear Oga MAT,

No let afraid catch you becos of ordinary Coro vaccine. After all, you don dagba finish, so if you take am and you peme, no wahala nau. Abi you no wan make awon boys take over Bose, Bisi, Funke and your buka babe Sikiratu wen you peme?

Flora Osagie

Benin City

Dear Oga MAT

If you like yoursef, take dat Coro vaccine wen di Alausa people come una garage wey dey near Ikeja under bridge. Number one, you be taxi driver, and na orisirisi passenger dem you dey carry every day in di curse (na real curse) of your duty.

How you go take know passenger wey get Coro and di one wey no get?

Number two, your age na im be di main di main target of Coro. Tank God say gofmen bring di vaccine come and dem wan nack una di vaccine after Oga patapata dem don take am. Lef wetin Mutiu talk.

Chidi Onyeama

Aba

Shey una see am?

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:23 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025