I confuse. Shey make I take di vaccine?

News Express |19th Mar 2021 | 1,298
I confuse. Shey make I take di vaccine?

I still remember dat time wen we be small pikin for our village for Ogbomoso, gofmen go dey bring orisirisi vaccine dey come nack us for body.

Na for hand, near shoulder, dem dey give us di vaccine, and na so we go dey cry.

Today dem go nack us vaccine for Polio, tomorrow dem go come again for TB. Anoder day for Yellow Fever, and so on and so on.

I still get like 3 mark for hand wey I dey show my two woman pikin dem - Bisi and Funke.

Now, gofmen don bring anoder vaccine come for Coro. I happy well well di day dem bring am come for Naija. I happy becos na we taxi driver dey meet orisirisi passenger dem everyday in di curse (Olorunmaje) of our duty.

Yesterday, Alausa send letter say dem wan come our garage wey dey near Ikeja under bridge on Monday, come give all our union member dem di Coro vaccine.

Our union chairman, Jimoh call meeting dat yesterday to tell us. Everybody happy say, gofmen recognise we taxi driver as important people. After all, no be everybody dem don give di vaccine.

But Mutiu come vex, e say why we dey happy, weda we no know say oyibo bring di vaccine to come finish us for Naija. Say di vaccine don already kill plenty people for order contry dem.

I tell Mutiu make e keep im mouth for permanent position of shut up, make e no talk wetin im no know. I ask am why our Oga Patapata for Aso Rock, im second and all di minister, plus including gofnor dem, never peme since dem take di vaccine.

Na im Mutiu talk one ting wey make all of us for garage shock.

Mutiu say we be original mumu. E say make we go again go look dat video wey dem show as Oga Patapata and im second take di vaccine, e say we go see say na empty syringe dem take do us boju boju for TV. Olorun Oba o!

My people, shey na true Mutiu talk? Abi na too much monkey tail and wee wee dey worry am?

Now, I confuse. I no know wetin I go tell di vaccine people wen dem come on Monday.

Abeg make una tell me weda or wedan't make I follow take di vaccine. Afraid dey catch me.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 11:43 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025