Tori Olorun! Yahoo Boy wan buy my shit (2)

News Express |9th Mar 2021 | 1,194
Tori Olorun! Yahoo Boy wan buy my shit (2)

We dey for Madam Shine Buka dey enjoy 9 o'clock pm in di night nack.

E come be like say make we no comot for dia again. True true, our union chairman, Jimoh ready to finish us with drinks and pepper soup dat night. I come suspect say Jimoh go don win Baba Ijebu.

Na dat time Sikiratu go tanda for one corner signal me make I come. I take style stand up like say I wan go piss.

As I go meet Sikiratu for dat dark corner outside Madam Shine Buka, Sikiratu come tanda with me face to face and body to body. E put im two hand around my neck.

Di next ting be say, Sikiratu hold me tight, e put im mouth for my mouth, bring out all im tongue, put am inside my mouth and begin use im tongue dance konkoma inside my mouth. I nearly faint. Tori Olorun!

After dat, Sikiratu begin use hand rub my head. Den e come say, “My honey Oga MAT, you know say I love you well well.” I tell am say I know and I love am too.

E say, “Honey, e get one ting wey I wan make you do for me if you love me true true.”

I tell am say I dey ready to do anyting for am. I no come know weda na me dey talk, abi na di 4 bottles of My Usual wey I don consume dat night.

Sikiratu come say, “Dat’s my Honey! Sweetheart, I wan make me and you sleep togeder dis night. I need you, and I know say you no go tell your sweet baby no.”

I wan tell Sikiratu no, but di babe don already set my body on fire. Everyting for my body don stand patapata like Standard Bank, and na so I come dey shake like Shakespeare.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 11:43 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025