Tori Olorun! Yahoo Boy wan buy my shit

News Express |5th Mar 2021 | 1,174
Tori Olorun! Yahoo Boy wan buy my shit

Too much enjoyment no good. In fact, if di enjoyment too much, e fit purge person.

Yesterday evening na so our union chairman, Jimoh take all of us for our garage wey dey near Ikeja under bridge, out.

E first come ask me make I tell am any better joint for Ikeja. I ask am like which kind joint? E say joint wia person fit relax, drink and wack better pepper soup.

I tell am say my joint na Madam Shine Buka wey dey near Airport Hotel. I say apart from drinks and pepper soup, na correct sisi dem dey serve di place. I even tell am say na for dia Sikiratu dey work.

Wen Jimoh hear dat one, im head scatter patapata. But e ask me weda dem get "point and kill". I tell am say na Madam Shine di main di main market be dat, especially now wey Aboki dem don dey do shakara with dia cow.

Jimoh say make I tell our union member make we meet by 6 o'clock pm in di evening, from dia we go drive for convoy go Madam Shine Buka.

E say di main people e wan na me, imsef, Idowu, Akpan, Emeka and Mutiu. Total, six.

Jimoh say e wan go spoil us for Madam Shine Buka. I ask am wia e from see money, weda e don win Baba Ijebu. Jimoh say make I lef matter for Mathias. Make we just go enjoy oursef, dat's all.

Dat evening, na so all of us land for Madam Shine Buka.

Come see enjoyment! No type of pepper soup we no chop - turkey, chicken, point and kill, nkwobi, cow tail plus including cow yansh, goat meat and kpomo. Akpan ask for 404 sef but Madam Shine tell am say next time.

We come take drink wash down di orisirisi pepper soup. Jimoh no spend dat day, e go be like 35k. Tori Olorun!

Dat one no include all di side attraction o. I remember say Jimoh begin chase Madam Shine, and di Igbo woman nearly use razor blade tear im pocket. Only di woman alone drink like 7 Odekun, plus 5 Nkwobi and 2 point and kill. And na so di woman jus gum for Jimoh body.

Madam Shine girls dem nko? Jimoh dash dem money plenty. Dem even drink and chop pepper soup join am. And na so Jimoh collect dia phone number one by one. But my Siki Babe give Jimoh my own number, Jimoh no know as Shine Shine Bobo wey e nack like 6 don entire im eye.

(To be continued)

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 11:44 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025