Burantashi plus free test available here!

News Express |2nd Mar 2021 | 1,595
Burantashi plus free test available here!

Na only Eledumare go save Naija people as tings dey go now.

Spare parts now na helele. I hear say dem even wan carry petrol price go up again, na im make long queue don show face for Abuja.

To see passenger carry sef na wahala. If you come our garage wey dey near Ikeja under bridge, all our union member dem dey complete nearly every day.

Some people for garage go play Draft, some Ludo and some go jus enter one corner go dey smoke wee wee, drink monkey tail to wash am down, and wait weda any passenger go show face.

Na so all of us siddon yesterday wen one aboki woman like dat waka enter. Di aboki woman use stick for shoulder take carry one kind bag for im back.

Di aboki lef everybody, waka come wia I siddon jeje dey tink of my life. E first take Hausa, abi na Fulani, greet me. Me sef use my original Ogbomoso language answer am.

Di next ting be say, e put hand for im bag, bring out one bottle wey some kind ting dey inside. E tell me “Market! Market!!”

I ask am which kind market e dey sell, di aboki woman use hand point my kini, and begin do sign of power. E say na burantashi.

I ask am wetin be im name. E say im name na Miriam, but im customers dey call am Man Power.

I come ask Miriam why e lef everybody for dis garage, waka come meet me to sell burantashi for. I ask am weda dem draw woman for my face.

Miriam say di way e take see me, I go like woman well well, especially small small sisi dem.

E bring out anoder bottle for bag and say dat one na Baaba, and na dis one I need. E say dis one, wen I DO finish, di sisi go begin hail me: “Baaba o! Baaba o!!”

Miriam say if I try di market, na everyday I go dey call am make e being am come.

Miriam come tell me say, if I wan test di market before I pay, no wahala, say I go do di test free. E come point hand for im kini. E say even if na now, e ready for me. Tori Olorun!

I smile. I tell Miriam make e no worry, say I dey wait for my passenger wey don pay me in advance to carry am for charter go Idumota.

I tell am say I go buy Baaba like four bottles, but make e bring di market, plus including di test, come on Saturday.

Miriam come happy well well. E ask me weda make e give me im phone number. I tell am make e bring everyting come on Saturday – di market, di test, and di phone number.

As di aboki woman dey happy dey go, I come talk am for my mind say na true say Boko Haram don enter Lagos.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 11:44 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025