After all di dance and shackies dat evening, e come be one week to Keresimasi, we no get any message or call from di Alausa bobo and madam.
See all di kind celebration wey me and all our union member dem don dey celebrate for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Shey 500k Coro cash palliative for one person na small ting?
I wan use my torch light chinko phone call di bobo and madam wey come take our details dat day, na dat time I come remember say I been forgot to collect dia phone number.
I only remember say di two both of dem been tell me dat day say dem dey work for Alausa, and Oga Sanwo-Olu tell dem to go round and collect name of people wey get paper to show say dem dey live for Lagos, plus other orisirisi details.
I also remember as dem talk say Oga Sanwo-Olu wan use am give Lagos people plenty money wey oyibo send come to take shock di knock wey Coro nack us for head, belle and pocket.
I remember as dem talk saydi money reach like 500k for one person.
But wetin been make me been forgot to collect dia phone number if no be say na oju kokoro dey worry me?
Small time Keresimasi and New Year come pass, na so we siddon dey expect message or call from Alausa ti-ti-ti-ti sote we come tire. Olorun Oba o!
Yesterday, our union chairman Jimoh call meeting as we dey do every week. All our union member dem for our garage complete.
Inside di meeting, na im my torch light chinko phone begin ring grin, grin, grin! I check am, no name. I use style signal Jimoh make I go pick di call for outside.
As I pick di call, one bobo come dey hala. E say why me and my people no wan come collect our money. I ask am who dey talk, and which money?
Di caller say na im be di person wey come our garage with one madam before Keresimasi, wey dem talk say dem come from Alausa.
I no know wen I jump and shout P-r-a-i-s-e di Lord!
I run enter our meeting place, put di phone for speaker.
Di bobo say dem don send message to all of us since one week after dem come our garage. I tell am say nobody receive any message for dat.
Di bobo say na lie, e say make I ask my union member dem. Di bobo no know say everybody dey hear am for speaker.
I tell di bobo say make e resend di message. E say no, say dat one don pass, make we wait for anoder batch. Tori Olorun!
Na after di call Akpan talk say di hole ting be like wayo. E say im dey suspect say, dis people jus dey go round dey collect people name and details wey dem go send to di oyibo wey send di money come.
Akpan say di money dey o, but dem go chop am, give some to dia own people and use our name take make di list long to show oyibo say dem give di billions of dollars to everybody.
As Akpan jus talk dat one, all our eye come red. So, some people wan use our head take chop money? Na lie!
All of us don plan to march go Alausa next week. Oga Sanwo-Olu must hear dis!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.