If you see di orisirisi dance wey my union member dem dance dat day for our garage wey dey near Ikeja under bridge, hmm, you go bow!
I no know say as dem old reach, dem still fit dance like dat.
Akpan di union social organiser open im taxi stereo patapata. Music come dey boom, and na so people wey pass for road stop to look us ti-ti-ti-ti like say dem drink one drum of lucozade.
Come see as my union member dem dance Azonto and ZANKU ZANKU. Old papa dem o. Tori Olorun!
Wen di stereo come play Fem, Davido song, na dat time everywia scatter. If you see Emeka, Akpan and Idowu, you no go know dem again.
Small time K1 song come dey play. Na so Jimoh and Mutiu head scatter patapata. Even me sef begin whine body. Na only God know wetin K1 a.k.a KWAM 1 put for dat im music wey be say any time e play, person no go fit control im body again. You must to jump up and dance.
Before you open eye sef, drink don full everywia. I no know say our union chairman, Jimoh don take style call one madam wey dey sell beer parlour near our garage. Jimoh make sure say e buy di drink wey everybody like.
Im own na Shine Shine Bobo, Idowu and Akpan own na Meta Meta. Emeka own na The Honourable. Mutiu own na Monkey Tail. Una kukuma sabi My Usual nau. Jimoh make sure say di madam supply everybody three bottles of im brand. Come see shakies and dance!
I come talk am for my mind say, dis one wey we dey celebrate so wen Oga Sanwo-Olu money never come, wen di money land nko?
And na 500k for one person be di money o. Oluwa o!
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.