Shey na me bring Coro come?

News Express |29th May 2020 | 1,542
Shey na me bring Coro come?

Dis Coro matter don come get as e be. Everybody jus wan use Coro chop money. Gofment o, company o, trader dem o, tailor o, all of dem dey target money.

All di ‘Obioma’ and Aboki wey dey carry sewing machine for head dey waka from street to street tele tele don become emergency facemask tailor.

All di woman dem wey dey sell tomatoe, pepper, tatashe, ororo, salt, isi okporoko and crayfish for bus stop night market don turn to facemask and sanatiser supplier.

Di sanitiser, na orisirisi dey. E get some wey resemble ogogoro, some be like say person piss inside bottle, some yellow, some white, some red, and some na all of di above. And all na sanitiser dem call am.

Facemask nko? Dat one na im worss pass. In short, no type of cloth wey dem no take sew facemask now – Ankra o, lace o, net o. In short, e remain make sisi dem use dia G-String dross do facemask. Tori Olorun!

Na so I go drop passenger for Costain di order day. Wen I come back for our garage wey dey near Ikeja under bridge, say make I rest small, Sikiratu enter.

Sikiratu bring orisirisi facemask come say make I follow am buy. I tell am say, as I dey so, di facemask wey dey inside dat my guonguoro pass 10.

I ask am weda e no dey work again for Madam Shine buka. Sikiratu say make I forget dat ting, say now every body dey hustle.

Sikiratu say if I no buy facemask for im hand, na im be say I no like am. Dis buka girl come flash me one kind wicked smile wey make my heart come dey do jigi jigi like railway.

Na so I come buy four facemask for Sikiratu hand o. Na wetin man go do nau?

As Sikiratu jus comot, Aisha enter, e no come carry im mobile buka for head. I ask am weda e no sell market today.

Aisha say na business e dey do now. Before I even ask am which kind business, Aisha wey dey carry ewa agonyi for head dey waka dey sell, open one bag like dat and bring out orisirisi facemask, say make I buy.

I tell Aisha say I get facemask yanfu yanfu. Aisha no gree o. E say im own na quality one, no be all dis pokunlowo e, wey peopledey carry waka upandan. Aisha say I must to support im market if na true say I love am.

Na so di son of man take buy anoder four facemask o. Olorun Oba o!

As Aisha begin go, I say make I jus go drive my guonguoro comot enter road go find passenger carry.

As I open di door to enter my pilot seat, na im one pelenge bobo wey be like broom waka come meet me. E say e wan make I follow am buy original sanitiser.

I tell am say na fake sanitiser I dey find since morning, no be original. Di bobo come look my face ti-ti-ti-ti. E say well, if na fake I wan buy, e get am too.

Na im I tell am say if e no run comot for dis garage now now now, I go call olopa for am.

I do like say I wan make call with my torch-light chinko phone. Come see as dis bobo pick race.

I come talk am for my mind say, oloshi ni yin. Shey my name na ObaniKoro wey make dem tink say na me bring dis Coro come?

Nonsense and Ingredients!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

American missionary disgraces Reno Omokri

American missionary disgraces Reno Omokri

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

JOA 2025: Fear of the unknown

JOA 2025: Fear of the unknown

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Senate steps down electoral bill for more consultations

Senate steps down electoral bill for more consultations

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Thursday, October 16, 2025 5:00 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025