Money for hand, back for ground (2)

News Express |19th May 2020 | 1,408
Money for hand, back for ground (2)

As di oga give me di cheque, I confuse. I begin dey sweat. I no fit tink clear with my head. If you see di kind money wey dis oga write for di cheque, afraid must to catch you.

I ask di oga weda na only me get all dat money wey e write for di cheque, e say make I jus manage am, say im sabi say all dat lockdown period, I no work. Na im make e say make e support me small with di money for di cheque.

I come dobale patapata for ground tank di oga. Una kukuma sabi how we Ogbomoso people go tank person wey do better for us nau.

I no come remember which road to take go Banana Estate from our garage wey dey near Ikeja under bridge. See me o! A hole Oga MAT wey don dey do taxi driver work for Lagos since Mary Slessor time! Money na wintch o!

But small time my eye come clear. Na im I come drive dey go to take IBB Bridge, from dia we go take Ikoyi and begin go Banana Estate make I go drop my better passenger wey Olorun send to me.

As we dey go for road, all my mind dey inside dat cheque wey my better passenger give me.

I come dey tink all di tings I go use di money do. My belle come sweet me, no be small.

Small time, we don enter Banana Estate be dat. We enter one street wey one big company dey. Di oga say make I drop am for di company gate.

As di oga jus come down, come see everybody for di company come dey greet di oga. Somebody open my guonguoro door for di oga to come down, anoder person carry di oga shine shine bag for am.One security waka for oga front, one for back, one for left hand side, anoder one for right hand. Na so dem escort oga dey go for im office upstairs.

As I wan turn my guonguoro begin go back, one sisi like dat for di company run come stop me. E say na im be oga PA. E give me card, e say na di oga say make e give me. Say oga say I fit call am anytime I like.

I tank di PA well well. As I look di card, na dat time I come know say na di Chairman/MD of dat big company I jus go drop for Banana Estate so. Olorun Oba o!

(To be continued)

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

American missionary disgraces Reno Omokri

American missionary disgraces Reno Omokri

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

JOA 2025: Fear of the unknown

JOA 2025: Fear of the unknown

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Senate steps down electoral bill for more consultations

Senate steps down electoral bill for more consultations

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Thursday, October 16, 2025 4:56 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025