NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
As we dey go for Lekki Beach, di sisi come tell me say im name na Sandra, say e dey live for California for America.
E say im papa and mama na Ghana, but dem carry am go America wen e be 7.
E say now im be citizen for America, and e jus finish im first, second and third degree for university, na im make e say make e come relax small for Naija for one week make im brain cool down small.
E say im papa and mama talk am tire say make e no come Naija, make dem no kidnap am, but e tell dem say at 22, im no be small pikin again. Dat's why e come lodge for Four Point for Lagos wey nobody go fit come kidnap am.
But e say to see person wey e go dey talk with for di hotel room be im troublem now. And e say e no wan sisi like am, and e no wan all dis small small bobo dem, na mature man e wan. I use corner eye look am as e talk dat one.
E come talk again say di mature man go first dey drive am around town make e see all di place for Lagos wey e dey see for television – like first story bulding for Badagry, IBB Bridge, Bar Beach, National Theater, Ajegunle, Mushin, Oshodi, etc etc.
Sandra say e go dey pay di mature man every day for di service, plus including to stay and talk with am forhotel room.
As we wan branch enter for Lekki Beach road, e ask me wetin be my own name. I tell am say my name na Olufemi Oluwabunmi Olugbemiro, but everybody dey call me Oga MAT.
E ask me wetin Oga MAT mean. I tell am say Oga for broken english wey we dey speak for Naija mean “Sir” or “Boss”.MAT na short form of Man About Town (M.A.T) becos of my work.
I tell am say no place for Lagos wey I no sabi becos every day I dey carry orisirisi passenger go orisirisi place for Lagos. And dat I don dey do dis work before im mama and papa born am sef.
As I jus talk dat one, Sandra come clap im hand, smile and shout "Good! That is it!!"
Sandra talk say since dat very time wen e see me, e don make up im mind say na me go fit render dis service till e go back to America next week. Tori Olorun!
E say as Man About Town, make I first drive am around town, and as we dey go around, we go dey branch dey eat and drink someting. Den for evening we go begin go back to hotel room togeder. And na so we go dey do every day. Olorun Oba o!
I come dey talk am for my mind say, if I follow dis sisi go stay with am for hotel room, my family nko – My wife Bose and my two woman pikin dem, Bisi and Funke?
But I come remember all di money wey we don go change for Adeola Odeku – 2,000 dollar! – wey we change wey full for inside dis my guonguoro as we dey go so.
Family. Money. Which one I go choose? Which kind temptation be dis?
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.