NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Lagos sisi dem don turn Xmas time to anoda ting patapata. Since wey Xmas don dey near, di kind smile wey sisi dem dey smile for man pikin dem, don enter anoda level.
Any sisi wey be say since dis year, e no dey greet man, as dis Xmas period don show face, just look dat sisi small, na so e go first smile, den come dobale, and greet you well well. And if di man no get sense, na so e go fall yakata for di sisi, e go tink say di sisi love am. Na dat kind one my friend Emeka go say, love onye ebe e? No be love anyting, na Xmas smile.
For dis my area, Abule Egba wey I dey live with my family so, plenty sisi dem go dey do like say dem no see me tele tele, talkless to greet me sef. Especially as dem dey see me everyday dey drive dis my guonguoro, dem just dey look me anya anya. I know dem go dey talk am for dia mind say, see dis poor old taxi driver. But since we enter for dis Xmas period, tory don change. If you pass and you no see dem, dem go make sure say you see dem, and wen your eye don jam with dia own, dem go come smile one kind smile like dat. Di next ting you go hear na, “Wetin you go give me for dis Xmas wey dey come so?”
On Saturday na so I enter my guonguoro begin dey go for our garage for near Ikeja under bridge. I no comot for my street sef, na so all dis small small sisi dem dey smile dey greet me left, right and center. I answer dem so-te my mouth begin pain me. Tori Olorun!
As I reach for garage, Akpan our union Treasurer, give me one letter like dat. E say na one sisi bring come for me.
Na im I open di letter, my broda, di ting wey my mouth see, my eye no fit talk am. Na Sikiratu write di letter o, dat girl wey dey work for Madam Shine buka wey dey near Airport Hotel o. Dat buka girl wey no go school before for im life!
Me, I sabi say I no go school, but at least I go night school reach Standard Five before I run comot for my village Ogbomoso, come for Lagos as Arike want put me for trouble say I give am belle, and Arike papa wey be babalawo nearly finish me.
Di letter wey Sikiratu write na list wey long pass di list wey sisi family dey give bobo wey want marry dia pikin. Na list of tings wey Sikiratu say I go buy for am dis Xmas.
See me see wahala o. Just becos di order day wey I go relax small with “my usual” for Madam Shine buka wen sun dey hammer me for road, I dash Sikiratu di N50 change wey remain, na im dis girl tink say I be Dangote, come drop Xmas list for me.
Sikiratu write say:
“My belove Oga MAT, good mony o. How walk? I say make I gif you dis my list with lof. Abeg you go baiy me dis tinks for my chrizmos o:
1. G-strin dross
2. Gold Necklest
3. Italya shoos
4. Oshodi Oke bra
5. Shimi
6. Half shimi
7. Oyibo hand bag
8. Risk watch
9. Chingkum
Oga MAT you no say I lof you welwel, and me sef I sabi say you lof me two. My lof, abeg buy efryting for me one week’s befor Xmas. By by o.
Na me your baby,
Sikiratu.”
My broda, una see my wahala? Na wetin make I do?
Make we jam again on Friday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.