Canada introduce 2026 allocations for international students, announce number of study permits

News Express |1st Dec 2025 | 76
Canada introduce 2026 allocations for international students, announce number of study permits




Canada don announce new immigration levels plans wey go increase di number of economic immigrants wey intend to come di kontri, and cut down di number of temporary residents, mostly through student visas.

For one update wey di Canada Immigration release on dia website dem unveil di plans for 2026-2028, wey include di plan to take in 380,000 permanent residents and reduce di number of pipo wey wan come di kontri for work and study.

Di statement explain say di reason na say Canada don enta phase of stabilization and no get plan to bring in more pipo, but to balance dia population wit di housing, healthcare and infrastructure capacity of di kontri.

For 2026, di IRCC dey expect to give out like 408,000 study permits.

Dis one go include di 155,000 permits wey dem go give international students wey just dey land and di 253,000 extensions wey dem dey give current and returning students.

Dis amount dey seven percent less dan 2025 wen dem bin target 437,000 and 16% less than di target wey dem bin get for 2024, to issue 485,000 permits.

All dis one na sake of di kontri overall work to reduce di temporary population for di kontri.

Dem also wan bring sustainablity to di immigration system. Di plan na to drop di total amount of temporary migrants for Canada to under five percent of di total population for 2027.

Oda changes wey dem dey put for inside di di immigration waka be say, from 1 January, 2026, as student wey do masters or doctorate for public designated learning institution (DLI) , dem no go need to submit provincial or territorial attestation letter (PAL/TAL) again wen dem dey submit dia study permit application.

Dem announce say dis na di groups wey no go need di PAL/TAL requirement for 2026.

  1. Masters and Doctoral degree students wey dey enrolled for public DLIs New
  2. Primary and secondary (kindergarten to grade 12) students
  3. certain Goment of Canada priority groups and vulnerable cohorts
  4. existing study permit holders wey dey apply for extension for di same DLI and for di same level of study.

Di number of study permits wey dey expected to go out for 2026 dey broken by student cohorts. E be like dis

  1. 49,000 Masters and doctoral students wey dey go public DLIs (PAL/TAL-exempt)
  2. 115,000 Primary and secondary school (kindergarten to grade 12) students (PAL/TAL-exempt)
  3. 64,000 oda applicants wey want PAL/TAL-exempt study permit
  4. 180,000 PAL/TAL-required applicants

For 2026, di 180,000 study permits for di applicants wey still need PAL/TAL go dey shared according to di provinces and territories dia popultion.

Di allocation go be:

  1. Alberta - 21,582
  2. British Columbia - 24,786
  3. Manitoba - 6,534
  4. New Brunswick - 3,726
  5. Newfoundland and Labrador - 2,358
  6. Northwest Territories - 198
  7. Nova Scotia - 4,680
  8. Nunavut - 180
  9. Ontario - 70,074
  10. Prince Edward Island - 774
  11. Quebec - 39,474
  12. Saskatchewan - 5,436
  13. Yukon - 198

Di overall number of study permit applications wey IRCC go accept for processing for PAL/TAL-required students for 2026 na 309,670.

Di number dey based on di application wry dey believed say each jurristiction go need to complete dia issuance targets based on di approval rate of stidy permit applications from 2024 to 2025.

Di numbers be

  1. Alberta - 32,271
  2. British Columbia - 32,596
  3. Manitoba - 11,196
  4. New Brunswick - 8,004
  5. Newfoundland and Labrador - 5,507
  6. Northwest Territories - 785
  7. Nova Scotia - 8,480
  8. Nunavut - 0
  9. Ontario - 104,780
  10. Prince Edward Island - 1,376
  11. Quebec - 93,069
  12. Saskatchewan - 11,349
  13. Yukon - 257 (BBC PIDGIN)

Comments

Post Comment

Monday, December 1, 2025 11:40 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025