






















.webp&w=256&q=75)






Loading banners
Loading banners...


NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Bedbug
Na NELSON DAFE dey nack dis tori
One man wey die for one Atlanta jail cell for America, dem say na .
“insects and bed bugs chop di man alive”, na wetin lawyer for di family tok.
Lashawn Thompson bin go jail and dem put am for di Fulton County Jail psychiatric wing afta officials say im dey mentally sick.
Family attorney Michael D Harper release pictures wey show Mr. Thompson body wey bugs scatter.
Im dey call for a criminal investigation and tell tori pipo say lawsuit dey wait for dem.
“We find Mr Thompson deadbody inside one jail cell wey dirty well-well afta insects and bed bugs chop am live,” Mr. Harper tok for statement.
'Dijail cell wey dem keep Mr. Thompson no good to even keep animal wey get disease. Im no deserve am.”
dem find Mr. Thompson unresponsive for im jail cell on 19 September - three months afta dem arrest am – dem confam say im don die afta attempts by local police and medical personnel to wake am up, according to USA Today.
Mr. Harper say jail records show say detention officers and medical staff bin notice say Mr. Thompson condition dey worse, but dem no do anytin to administer aid or help am, di BBC US media partner CBS News report.
Di medical examiner report say im bin get “serious bed bug infestation” for im cell for di psychiatric ward but im add say clear signs of trauma for Mr. Thompson body no dey.
Di report say dem no know di cause of death.