Plenty people don dey regret to marry many wife. Even big man dem sef. I read am for one vendor hand last week.
And since wen oyibo come our land, dem come dey tell us say make we marry only one wife.
But my own no be becos of oyibo I marry only Bose. Na me know di reason, and abeg, no ask me di reason becos even if you ask me, I go tell you No Comment.
But now I don change my mine. True true, Bose don born two woman pikin for me – Bisi and Funke. And no be say I dey find anoder pikin o. Wetin I go take anoder pikin do as I don dagba finish? Bose sef no be small pikin.
Di ting wey I wan now na new wife wey go dey scratch my back anytime I come back house.
E no easy to dey drive around di hole Lagos from morning till night. If passenger no take you for drop or charter go Isale Eko or Idumota, e go be Ajah. If e no be Ikorodu or Epe, e go be
Ibeju Lekki or even Badagry sef.
Na im make I dey always talk am say, dis our taxi driver work no be for person wey no get small power for body.
Wen di son of man don do all di wahala for Lagos road finish come house, atlist person suppose cool down small. After all, body no be wood or iron.
My own be say, since Bose born our two pikin dem finish, e no dey look my side again. If I come back, e go say make Bisi or Funke give me food. Now wey Bisi and Funke wan enter uniservity after dem don jam JAMB nko?
Dat one sef no be di main, di main wahala.
See like yesterday wey Go-slow dey everywia for Lagos as dat rain fall finish, I go drop one passenger like dat for Onyigbo. As I drop di passenger finish, e take me like 4 hours from Onyigbo to go reach our garage wey dey near Ikeja under bridge.
As I manage reach garage, I check time, 10 o'clock pm in di night don nack. And all our union member dem don close. Na im I say make I kukuma begin go my house wey dey for Abule Egba.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.