E be like say I go stop to take My Usual (2)

News Express |10th Sep 2021 | 939
E be like say I go stop to take My Usual (2)



Na two sisi dey serve drink for dat Obalende joint. Di order sisi dey serve point-and-kill. Di way I see dem, di three both of dem go don born tire for village before dem come dey do sisi for Lagos.

I tell one of dem make e serve me My Usual. Di ting cold for dia sha. I take two bottle, e no be like say I take anyting. Na im I top one again for di road.

I look time, e don dey go 7 O’clock pm in di evening. I bring out 1k give di sisi wey serve me. I say make e give me change. Na so di buka girl jus dey look me anya anya like say I be Taliban.

I tell am say make e do quick, say I dey go mainland and time don go.

Di sisi tell me say my money still remain N500. I say for what? Shey no be di ting wey I buy N300 for Madam Shine Buka for Ikeja on Saturday?

Di sisi begin hala. E say abeg make I give am im money quick make e go answer order customer dem.

E say weda na from moon I drop wey I no know say everyting don cost for Naija.

E say na my old age e dey respect, if no be so, e for don drag me for my shokoto trouser. Shiioorr!

Na so all di customer for di joint come dey look me o.

I bring out di last 1k wey dey my pocket give di sisi and collect change.

Na so I begin enter road dey come from Obalende to Abule Egba dat night with only N500 for pocket. If my guonguoro tyre been go down or anyting happen for road dat night as I dey come nko?

Na im make I don dey get second mind on top dis My Usual wey I dey nack every evening after work to take relax my body. After all, di ting no be food.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:18 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025