Helep! Bose friend no let me rest (4)

News Express |3rd Sep 2021 | 1,025
Helep! Bose friend no let me rest (4)



I come talk am for my mind say, so if na only me dey house, na so Philo for rape me for inside my own house o. Tori Olorun!

I tell Bose make e come meet im friend for parlour. As Bose come out, me I enter for bedroom. I wear my shokoto trouser and jumper, carry my guonguoro key. Na so I lef di two both of them for house, enter my guonguoro and begin dey go our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I jus enter garage wen my torch light chinko phone begin ring. I check, no name of di person wey dey call.

I jus say make I pick di call, di person come dey ask weda na Oga MAT be dis. I ask who dey call. E come say, “Na me Philo, your wife friend.” Tori Olorun!

I surprise gan as dis woman take get my number and di mind to call me.

Philo come talk for phone say im know say I surprise as e take get my number but e say make I no begin suspect anybody for my house, say di person wey e collect my number for im hand no live with me rarara.

Philo come tell me say make im go straight to di point. E say e like me and e wan taste everyting wey dey my body.

E ask me why I no quick tell am say Bose dey with me for house dat time. E say to say my wife come out come see am as e hold me nko.

Philo come ask me weda make e come meet me for garage make I take am out go make am feel like woman.

See me see troublem o! Philo wey run comot and lef im five pikin for husband house o. Wetin I wan take dis after 5 woman do wen be say na only two Bose born?

I no come know wetin to answer dis akpruka woman for phone. Na so I jus hold do phone, I no make pim till di line cut.

My people, abeg wetin make I do? Shey make I tell Bose how di woman wey dey call am “my friend” no let me rest?

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:18 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025