Dat runaway housewife Philo na real akpruka woman. Upon say e born five pikin before e run comot for husband house, Philo still dey do like say e never even drop one before.
But I come talk am for my mind say, if dis mama of five comot everyting wey e dey take do padding for im yansh and headlamp before e wear clothe on top, shey any man go look am second time?
Yesterday I say make I rest small for house before I begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge. Na only me and Bose dey house, our two woman pikin dem – Bisi and Funke – say dem dey go for special morning service for dia church wey dey Pen Cinema.
As e come remain only me and Bose for house, I jus dey turn body for chair. Small time I enter bedroom go lie down for bed, I call Bose. I jus wan see weda we go do bend bend sleep small.
Bose open di bedroom door and come inside. E ask me why I call am. I tell am say my back dey scratch me, make e come for bed come helep me scratch am small.
Bose say “Baba Bisi, abeg come begin dey go your garage. I no dey for di mood for dat ting wey you dey find so”.
I tell my wife say na only to scratch my back I wan make e helep me do, no be anoder ting. Bose say make I swear. I tell am say, “I swear! If I lie make I tanda naked baf for bafroom”.
As Bose begin come meet me for bed, na im we hear knock for parlour door pom, pom,pom! Tori Olorun!
I use style go check who be di person wey come put sand sand for my garri dis very crucial time.
As I open di parlour door, na Philo dey dia. Which kind wahala be dis?
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.