Helep! Bose friend no let me rest

News Express |24th Aug 2021 | 1,025
Helep! Bose friend no let me rest



I still remember how dat wicked Arike Papa wan take African Insurance finish me becos of say im pikin wey we dey siddon togeder for Standard 5 for our village night school carry belle.

Na im make, since I run comot for my village for Ogbomoso come Lagos, I dey mind mysef. I no wan any wahala with any woman.

I tank Eledumare say e give me my own wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke. Dat one don do me.

But you know say dis our taxi driver work na ashewo work. E come be like say all dis Lagos sisi eye dey for my body. Sikiratu, di buka girl, dey one corner. Yetunde wey dey come sell Agbo jedi for our garage dey anoder corner. Iyabode, di mobile buka girl wey dey carry Ewa Agonyi for head come, dey dia too. Tori Olorun!

All dis Lagos sisi dem no wan know weda or wedan’t you don dagba finish, dem wan do. But me I know as I dey take follow all of dem.

Di one wey dey ground nowna my wife friend, Philo. Dis woman don born five pikin run comot for husband house o.

But everyday wen I don comot for house go work, na so Philo go go meet my wife Bose for our house wey dey for Abule Egba.

Philo go carry wrapper, blouse, pancake, tido, ear ring and even dross, go meet Bose for house make e buy. And I don kukuma tell my wife teletele say, if e collect anyting for credit for Philo hand, dat one no concern me.

Small time, I see say any small time, Philo go come house. E go say e wan pass for our street but e say make e jus branch greet us. No do, no do, Philo don dey call Bose "Ore mi".

One day I ask Bose when, why and how e take be Philo friend. My wife say e no understand dat kind question, weda e be small pikin. I say no troublem.

Na yesterday I comesabi di main di main reason why Philo dey always branch for our house now.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 9:18 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025