Before I say jack, di three hefty bobo don land for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
I jump enter my pilot seat.
Dia oga wey dey talk with me since, give dem sign make dem enter my guonguoro. Two of dem enter back seat, one enter front.
I come talk am for my mind say so na amu robber dem I dey carry go for operation so. Na im be say me sef wey drive dem go di operation, I be amu robber too. But wetin I go do at dis point wey dem no go use bullet scatter my head? None of our union member dey for garage. Olorun saanu mi o!
I no come see dia oga again. I ask di one wey siddon with me for front weda e sabi di joint for Palmgrove. E say make I jus dey go, say im go direct me.
I open ignition, start engine. As I wan move, e come be like say di hot piss wey dey worry me wan begin drop. Na im I tell di one for front say make I run go piss come. E say make I go quick come.
Di piss don nearly begin dey drop for ground sef before I enter di small hut wey we dey piss for our garage.
I run come back, enter my guonguoro, put am for gear one. I don dey drive amu robber dem dey go for operation be dat. See me, see wahala!
I never see before di kind traffic wey dey for road as we dey go. From Leventis bus stop to Anthony for Ikorodu Road nearly take us like 3 hour. Before we reach Palmgrove, night don come.
All di time wey we dey come for road, dis three bobo dem no jus open mouth. Dem no jus make pim. Instead, dem come dey form sleep.
Wen we reach Palmgrove, di bobo for front direct me go one joint like dat. Di place na beer parlour like Madam Shine Buka wey dey for Ikeja.
But come see people for dis Palmgrove joint. People plenty pass market. Even band stand dey wey play dey entertain people like Owambe party. Plenty customer dem siddon for outside wey be open street.
Di three bobo wey I carry go say make we siddon for outside. Dem order for drink and point-and-kill pepper soup. Dem ask me wetin I go drink, I tell dem say I dey do fasting.
Na so dis three hefty bobo dem shack and smoke orisirisi smoke ti-ti-ti-ti for dat joint.
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.