Na only Eledumare dey save person for dis taxi driver work wey we dey do so for Lagos.
Na im make, wen I work finish go home, I dey tank Eledumare well well.
If I tell you all di orisirisi tings wey I dey see for Lagos road every day, afraid must to catch you.
Na so I siddon di order dey for our garage wey dey near Ikeja under bridge, dey look road ti-ti-ti-ti weda passenger go show face.
Wen one bobo like dat waka come, my mind come sweet gan. I come talk am for my mind say, atlist I don get my first passenger dat morning.
Di bobo first go meet our union member Mutiu wey siddon one corner dey smoke, with one bottle of Sapele Water a.k.a. Push Me I Push You, to take balance di smoke. I see as Mutiu point hand for wia I siddon.
Di bobo come meet me, e ask weda na me be Oga MAT. As correct Naija man, me sef use question to answer im question. I ask am why im dey find Oga MAT.
E come talk say na person give am my name say I be correct taxi driver. E say di person tell am say if e charter me for any job, I no go fall im hand lai lai.
Di bobo come tell me say e wan charter me for one business dat yesterday night. I ask am weda na all night, e say No. E say I go jus carry three of im boys for my guonguoro go one place for Palmgrove, im go dey drive follow us for back.
E say I go wait for dem outside di place, but I go turn my guonguoro face di direction wey I go fit drive comot immediately wen dem finish and jump inside my guonguoro, den I drive off with full speed. Olorunoba o!
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.