Since yesterday, I no gree make any passenger wey no cover im nose enter my guonguoro as gofment talk say Coro don come back.
Dem even talk say, di kind one wey don enter Naija now, na Coro senior broder, and e wicked well well.
Dat yesterday, one bobo like dat waka with im sisi come our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say make I carry dem for drop go VGC.
I tell am my price, e gree. E even bring out di complete money to give me. But I first ask am weda dem get facemask. Di bobo say dem no get.
I wan run go buy am for di two both of dem. Di bobo say no need. E say im no believe all dis ting wey gofment dey talk say Coro don full ground again.
I ask am how? Di bobo come ask me weda I sabi or see anybody for my area or street or house wey Coro don kill. I say no. E ask me weda Coro don catch any of our union member dem. I say Olorumaje!
E say, so why I follow dey talk say Coro don come back. I tell di bobo say na so gofment talk, and I dey hear di news for radio and television.
Di bobo come tell me say weda I no know say Coro na business for gofment people. I ask am how. Di bobo no gree talk again. E say if I no ready to carry dem, make I siddon dia dey look road.
Na so dat bobo and im sisi waka comot with di money o. Tori Olorun!
See me wey no gree carry passenger becos of say dem no gree cover nose. And e come be now wey be say to see one passenger carry na helele.
I come talk am for my mind say, dis time na rainy season wey cold dey catch well well and bring catarrh, cough, headache and fever. Shey na im be dis Coro senior broder?
Abeg o, anyting wey go make gofment bring anoder lockdown, I bind and cast!
Di ting wey my mouth see last year for lockdown, my eye no fit talk am.
I use Eledumare name take beg dem o. Joor!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.