Di way I see dis our Naija, if e continue like dis, one day go be one day, nobody go dey inside again, everybody go don vamus.
Since dis week, na so so passenger dem wey dey go airport I dey carry.
Di ting good for me gan, I swear! At list I dey see plenty money go home for my family.
No be only dat, I dey also see small money inside take go empty like four bottle of My Usual for Madam Shine Buka, plus including pepper soup to take escort am.
No day, since we enter dis week, wey I no dey branch for Madam Shine Buka before I begin go house wey dey for Abule Egba. Wen I reach house for night, my belle go don full well well, but still, I must to try chop di food wey my wife Bose keep for me. If no be so, hmm, na big wahala be dat o.
Di first day dis week, one sisi and one bobo come our garage wey dey near Ikeja under bridge. Dem come around 5 o'clock pm in di evening. Dem carry big bags like 7. Dem say make I carry dem go drop for airport.
I ask dem which airport, weda MM1 or MM2. Dem say na International dem dey go. I tell dem my price, dem gree. I say make dem enter. All dia big bags no fit enter for my guonguoro boot. I put some for passenger seat. I tell di bobo make e siddon for front seat, di sisi dey for back.
Wen we dey go, if you hear wetin dis two people talk about Naija, afraid must to catch you. Na so I jus dey listen but I do like say I no hear wetin dem dey talk.
Di two both of dem na dokita. Dem say gofment dey owe dem salary and allowance for plenty months now. Na im make dem resign to go start work for oyibo contry. Dem say di salary for dia na times 50 wetin dem dey take for Naija wey gofment no dey gree pay dem sef. Dem never talk finish wen we reach airport, and I drop dem.
Di second day dis same week o, anoder two people take me for drop go di same airport for evening. Dem say na night flight dem wan take go oyibo contry. Dem be two sisi, one na nurse di order one na person wey dey test people blood.
Dem dey complain di same ting wey di order two passenger dat first day complain. But dem come add all di Boko Haram and kidnap matter wey dey go on now. Dem say dem no wan siddon for hear make aboki nama carry dem go inside forest go begin nack dem.
Di two sisi even talk am say, lai lai dem no go ever come back to Naija as dem wan check out so dat night. Dem say patapata dem go marry oyibo for dia, as dia papa and mama don kuku peme for dia village. Tori Olorun!
Anoder day and anoder day, na di same ting up till yesterday. All my passenger dem na international airport dem go, and all of dem na to check out. Haba!
Na im I come talk am for my mind say, as I sabi dis my taxi driver work reach, I fit go do am for oyibo contry dey collect better money o. And dat one go be dollar, no be dis our money wey don dey be like paper wey dem dey use clean yansh for toilet.
But how I go do with Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke? Na my troublem be dat. But I still dey tink am.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.