Dat Tuesday wey Sallah start, I say make I siddon for house with my family. After all, no be too much work make Dangote get money.
Cubana wife don kukuma talk di order say na grace make im husband get money nyafu, nyafu. Since wen I hear dat talk, I don dey find any sisi wey im name be grace make me sef take am do side chick weda I go get money like Cubana.
Na di ting I siddon for parlour for our house wey dey for Abule Egba, dey tink ti-ti-ti-ti...
Na so my torch light chinko phone begin ring. I look am, na Sikiratu dey call.
Sikiratu tell me Barka de Sallah. I tell am same to you. E ask me wia I dey, I tell am say I dey my house.
Sikiratu talk say e dey for our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say nobody dey dia.
I tell am say today na Sallah, and Jimoh our union chairman, Idowu our union treasurer, Mutiu and orders go don dey kill ram and cook rice, dey enjoy di Sallah with dia family.
I tell am say Akpan, Emeka, me and orders wey no dey do Sallah go dey house with our family. I tell am say we taxi driver sef need rest, body no be wood.
Sikiratu say make I drop anyting wey I dey do for house now, begin come meet am for garage, say e get one beta ting wey e wan show me.
My broder, I no know di kind juju wey Sikiratu put for mouth take call me. Before 15 minute nack sef, I don land for garage as all di road dey free for dat holiday.
Wen I see Sikiratu like dis, all my body begin stand paparapa like Standard Bank, and na so I come dey shake like Shakespeare.
To say I no sabi Sikiratu reach ground, I for tink say e been study packaging science for school, but di buka girl no go any school, na expert to package body.
I come dey swallow saliva wen I see di two paw paw wey tanda for Sikiratu chest. Di ting jus point like say e wan chuk my eyes. Di boysquarter nko? Dat one na helele. Na so di ting come shoot out well well. Tori Olorun!
I off engine but as I wan open door to come down, Sikiratu don open di passenger door and enter.
As e siddon for inside my guonguoro, Sikiratu jus open im too leg yakata! And na so my eye go land for im kini. I see say Sikiratu don prepare di kini well well for me. E don clear di bush, rub am powder and perfume, waiting for me to enter. Olorun saanu mi o!
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.