I no come understand as Naija come dey now. E be like say one aje dey one corner wey dey swallow people money.
Nobody gree say e get money again. And na true. Di money wey I dey give my wife Bose every week make e take maintain house, Bose dey cry now say e no reach again.
Bose tell me di order day say, if e carry money go market to buy food, na so di money go jus finish for im hand, and e no go see any better ting wey e take am buy. E go come be like say person tief di money, but wen e begin count am, e go see say nobody touch di money.
Na my own bad pass sef. To service my guonguoro now na helele. Before before, I dey service am every month make di ting dey move well. Na im make, na di motor wey I buy since before I marry my wife, den come born my two woman pikin dem - Bisi and Funke - na dat same motor be dis my guonguoro till today. E dey move pass all dis new motor wey dem dey sell now. But as tings come dey now, who born dog wey I go dey service am every month again?
Now money to buy spare part, engine oil, petrol, all don jump fence. And di wors of all be say, no passenger dey look our side wey dey drive yellow taxi again. Tori Olorun!
Dat’s why, yesterday wen I go drop one passenger for Omole gate, as I dey come back, I branch for First Gate wey mechanic village and spare part market dey. I go dia go try weda I go fit see anybody wey go buy dis my guonguoro make I join money start anoder business.
One mecho wey I meet for First Gate tell me say if true true I wan sell am, make I bring am come park for im workshop and put on top "For Sale". Say I fit get lucky make person buy am, but im own share na 20 per cent becos na im go dey warm am everyday.
I come talk am for my mind say, dis bobo no sabi say before dem born am for im village, I don dey do mecho work for Lagos before I come be taxi driver. Na oju kokoro (insected eye) dey worry am.
Na im make I come nack am join dis my tori today say, anybody wey wan buy Naija used second hand tokunbo, make e come inspect am for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.