See me, see wahala! My wife wan open beer parlour

News Express |13th Jul 2021 | 1,015
See me, see wahala! My wife wan open beer parlour



Abeg make una helep me tell my wife, Bose say no be every business good for woman to do.

We wey be taxi driver sabi wetin dey happen for town. Wen I don drive tire, I dey always go relax for joint to eat and take My Usual. And if extra money dey my pocket, I go add pepper soup join am.

I sure say, all of una know say Madam Shine Buka na my regular joint.

Plenty of all dis joint na woman dem dey run am. Some of dem na housewife, some na widow. But plenty of dem na woman dem wey don run comot for dia husband house.

If you see wetin customer dem dey take dis woman dem dey do for all dis joint, hmmmmmm!!! Una kukuma sabi say nearly all dia customer na man dem be.

Di customer dem go dey buy drink for dem, and dem no go say no. Na im make all of dem na shacker dem be. Dem fit drink anyting.

Customer one go dash dem Shine Shine Bobo, dem go drink am. Customer two go give dem De Honorable, dem go collect. Customer three go buy Meta Meta for dem, dem go nack am. Odekun nko? Dem go shack all. And after dat nko? Na so all di customer go dey take turn for kini one by one. Tori Olorun!

Tell me, dis one and di woman wey dey do full time for hotel, no be di same ten and ten pence?

Na so I come back yesterday night for my house wey I dey live with my family for Abule Egba. My wife Bose begin tell me say, as I no let am do di oyibo night work, e get business wey e wan do. E say e wan begin sell beer parlour.

My wife say make I no worry for di money, say one micro finance bank don gree to give am di money to take start di beer parlour business. Olorun Oba o!

Up till now wey I dey nack una dis tori so, I never get mysef since dat yesterday night. Olorun saanu mi o!

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 1:20 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025