Me sef wan be Minister

News Express |9th Jul 2021 | 987
Me sef wan be Minister



Wen I dey tell una say one day go be one day, I go be Chief Driver for Aso Rock, una tink say na “My Usual” dey shack me.

I know say, if I make mistake enter as Chief Driver, I fit come out as anyting, even as Oga patapata of Naija. Yes ke!

I happy well well yesterday wen I hear di tori wey di two bobo wey I carry for drop go Oregun dey nack.

E be like say di two bobo na twin broda dem be.Dem resemble gan. Dem carry di same tall, di same bie bie, di same big head, and even wear di same clothe. I sure say dem go dey nack di same sisi sef, and di sisi no go ever sabi who be who, becos di two bobo too resemble. Tori Olorun!

Dat one sef no be di koko. Di main di main ting na di tori wey dem nack since wen dem enter my guonguoro for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Dem dey talk about one Aunty wey dey hold all our Naija money tele tele.

I no even know say dem been pursue dat Aunty Kemi comot for Naija becos say e go meet Oluwole printer make e give am one kind paper to take be Minister. Na for di two broda mouth I hear am as I dey drive dem go Oregun day before yesterday.

Na also for dia mouth I hear say Aunty Kemi been go court to tell court say wetin e do no be bad ting.

And na for dia mouth I hear say true true, court concour dat day gan gan say Aunty Kemi no do bad ting.

Dem say court even talk am say, you no need to show anybody any paper to become Minister, weda Oluwole paper, Mushin paper or Daura paper sef. Olorun Oba o!

If you see as my belle sweet wen I hear dis ting for my passenger dem mouth! Ehn?

Na im make, I don dey ready small small becos dis 2023 wey dey come so, I go park dis my guonguoro for one corner.

I must enter Aso Rock. If no be as Chief Driver, e go be as Minister or VP academics (Na anoder passenger been call dat name o)

And make anybody tanda for road to ask me for any paper, I go show dat person my red eye. I go show dat person say dis Naija na all of us get am, no be one person.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Monday, October 13, 2025 1:11 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025