Soup wey sweet, na money kill am

News Express |15th Jan 2021 | 1,418
Soup wey sweet, na money kill am

Since dis new year show face, I jus dey gbadun. Life sweet no be small.

Na my guonguoro give me joy pass. Since wey I upgrade am, everyting jus dey jolly jolly. My guonguoro now dey run like new born baby, no stress.

All dat “e dey do over heat”, “e dey chop oil”, “brake pad don chop”, “e dey do break and quench,” etc etc, don stop. All dat wahala don follow 2020 go.

In fact, very soon anybody wey call my taxi guonguoro go hear nwi for my hand. Guonguoro be like to call woman old cargo, abi I lie?

See like di order day wey one oga like dat come our garage wey dey near Ikeja under bridge.

If you jus see di oga, nobody go tell you say na big man e be. You go jus know. Everyting e wear for im body dey smell money.

As di oga enter di garage, our union member dem begin rush am. “Oga wia you dey go!” “Oga make I carry you!!” “Oga see my taxi, e go carry you go anywia!!!" Na so Jimoh, Idowu, Emeka, Akpan and Mutiu jus dey rush di oga.

Dem surprise as di oga point for my guonguoro body, e ask, “Who is the driver of this?” Na so I waka jeje go meet di oga.

Oga tell me say e jus arrive for airport, e say make I carry am go im head office for Victoria Island. E say I go wait for am, den carry am to airport make e catch afternoon flight back to Abuja.

I tell di oga my price, e gree. Na im I open passenger back door for am, salute am as e dey enter, close di door and salute am again, den jump inside my pilot seat.

As we move, na so our union member dem jus dey look me ti-ti-ti-ti. Shiooorr!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 4:51 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025