Wen we drive pass people for di road, dem go jus dey look ti-ti-ti-ti to see wetin dey make noise like tolotolo inside the two Hilux and my guonguoro. Dem go come see say na turkey we dey carry.
From Sango Ota, we pass Kollington, Alagbado and Meran. As we wan pass Abule Egba, na im I blow my horn pom, pom, pom! I point hand to show dem say na di street wey I dey live with my family be dat.
Small time, we don reach Pen Cinema, pass Moshalasi, Alhaja, Otubu den Guinness, Second Gate and Nigerite. As we wan reach traffic light wey dey for dat First Bank, one of di Hillux overtake me and stay for my front.
Wen di light show green, dem signal me make I drive follow dem enter Adeniyi Jones. Wen we reach Wahum junction, dem drive go right, den left, into Wemabod estate. Na so I jus dey follow dem like mumu.
As we land for Councillor house inside di estate, come see crowd. Tori Olorun!
We drive inside di big compound, stop, open door and come down. My two passenger dem and di two Hillux van driver begin bring out di turkey. I join dem to remove di turkey wey plenty reach like 350. Olorun Oba o!
After we offload finish, dem pay me my money, still add two big turkey. Dem say na Councillor say make dem give me. E remain small, I for begin dance ZANKU for dat place wey people full everywia.
I collect di money and di two turkey. I tank dem well well. I say make dem helep me tank Councillor for me. Say God go bless dem and Councillor well well. Say dis new year go better for Councillor and im family gan.
I say as Councillor remember me, Eledumare go remember am for everyting.
After I pray for dem finish, I chuk di money inside my shokoto trouser, put di two turkey for my guonguoro and enter captain seat. I don dey go be dat.
I no come go our garage wey dey near Ikeja under bridge, na house I face.
As I jus land for our compound for Abule Egba, I blow horn make my wife Bose, and my two woman pikin dem - Bisi and Funke- know say I don come back.
My people happy to see di two giant turkey, no be small. We bring dem out and tie dem for backyard, near my room window. I put mark for dia body make nobody make mistake carry am.
We come dey feed di two turkey from dat Monday afternoon. I dey check dem till midnight wen sleep catch me.
Na Tuesday morning wen I say make I rush go give dem food, I see say my two turkey don disappear. Tori Olorun!
Na so I begin shout! I shout sote even our nebor dem for di next street come out to see wetin dey happen.
Me, I suspect di person wey thief my two turkey. I know say e no go pass Braimoh, my landlord pikin.
Braimoh own no pass to stand for street with im friends and smoke igbo from morning till morning. I know say if I give am small chance, Braimoh go sell my two turkey one time.
Di ting wey I do be say, as I dey shout, I dey talk say if anybody wey carry my two turkey wan to see di new year, make dat person bring back my turkey immediately. I say if e pass jus one minute of crossover night, di person go follow year 2020 go.
Na im I run inside, bring water for big white basin, take broom dey sprinkle di water every corner for di compound.
As I dey do so, I dey talk waiting other people no fit hear. I jus dey move my mouth up and down like babalawo.
My broder, day never break finish dis morning wen I hear my two turkey dey shout “Happy New Year” in dia own language near my room window.
Happy New Year to everybody o!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.