Since wen I don dey do dis my taxi driver work tipe tipe, nobody dey hear my voice. Na only dis my tory wey I dey nack una be my own. And I know say una dey enjoy am gan.
Everyday wen I close, I go go for Madam Shine buka go take My Usual to take calm down, or I go kukuma go my house wey dey for Abule Egba. Nobody fit talk say Oga MAT dey find am troublem.
But see di order day, I dey my own jeje. I jus go drop passenger for Amuwo Odofin come back, I say make I rest small before anoder passenger show face.
Na im our union member Mutiu come siddon for di same bench wey I siddon. E first open satchet, begin drink hot wey dey inside di satchet. E drink di first one, drink di second one. E drink sote e enter 10 satchet.
Di next ting be say, Mutiu bring out cigar, light am and begin smoke. Instead make e dey blow di smoke for anoder side, na for my face Mutiu begin blow im cigar smoke. Tori Olorun!
I tell Mutiu say I no like wetin e dey do. Come see Mutiu begin spark like fire wey dem pour petrol inside.
Mutiu say why I go tell am make e no smoke, say garage na all of us get am, no be only me. E say e get di right to smoke anyting e like, any time, any wia, any how.
I tell am say garage na public place and e no suppose smoke for dia.
Na dat time Mutiu jump up. E hold me for neck and say if I talk again pim, e go kill me and take my body do pepper soup. Olorun Oba o!
Jimoh our union chairman jus drive enter garage dat time. Na so Jimoh rush come begin drag Mutiu hand comot for my neck.
Jimoh begin hala for Mutiu, e ask am wetin I do wey e come dey fight alagba like me.
I tell Jimoh wetin happen, Jimoh vex begin call olopa for phone make dem come carry Mutiu. Na so Mutiu give Jimoh one dirty slap like dat for face pppooouuuaaarrrrhh!, and disappear.
As I dey nack una dis tori so, nobody don see Mutiu again since dat day. But somebody talk say Mutiu don run go im village for Kogi.
My own be say, anywia Mutiu like make e run go. If e like make e run go hide inside forest for im village, I go bring am out.
Mutiu own don too much. Na everyday e dey fight for garage. If e no fight Emeka, na Idowu or Akpan or Jimoh.
Na dat sachet ogogoro dey disturb am. And e dey mix am with Alomo and monkey tail. And wen e smoke cigar finish, e go use igbo take top am. Any time you see Mutiu eye, na so e dey red like fire.
Na im make all im wife don run lef am for Lagos. All im pikin dem, no one dey live with am.
If you see Mutiu, mosquitoe sef fat pass am and na so im neck long like ostrich own. Shey na dat kind person I go follow fight make dem talk say Oga MAT don kill person?
My own be say, I must find Mutiu any wia e dey, carry am come give olopa. If na for inside im village forest e go hide, I go use Amotekun go bring am out
I trust Amotekun. Na dem be di people's police now. I hear say dem get African Insurance wey be like magnet. If any criminal run go hide inside forest, dey must to bring di criminal out.
Abeg who sabi wia Amotekun dey? I dey find dem.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.