Since wen I come Lagos before di war, come learn mecho work and after dat I begin do dis my taxi driver work, my belle no sweet like dis.
All of us for my family – me, Bose my wife, plus including my two pikin Bisi and Funke – na every morning and night we don dey pray now and tank Olorun since di day we hear di good news.
And I sure say na di same ting dey happen for all my union member dem family.
On Friday, our union chairman for Lagos State come do emergency meeting with us for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Jimoh, our branch chairman, tell me dat morning make I call all our member and tell dem say any wia dem carry passenger go dat Friday, make dem make sure say dem come back for garage before 12 o’clock pm in di afternoon.
Jimoh talk say anybody wey no attend di meeting must to pay N5000 fine, and nobody must come late. No be say our state chairman go come siddon for garage dey wait for us.
Na im make, dat day all our union member dem complete for di meeting. Some no even gree carry passenger go anywia make dem no go jam Go--slow for road.
Wen di state chairman come, all of us don already siddon dey wait for am, but even Jimoh wey be our branch chairman, me wey be secretary and Idowu wey be treasurer, no know wetin di state chairman wan come tell us.
But tank God say na good news e carry come.
Di state chairman talk say, all di suffer wey Uber and Bolt driver dem dey make we yellow taxi driver dey suffer don stop.
E say one company don bring out new someting like dat wey dem go fix for our taxi make passenger dey use am hail us and we go go carry dem as Uber dey do.
E say na one Naija man company bring out dis new hail someting and we go only pay N2000 every month and take all di rest money, even if we carry one million passenger every day. Tori Olorun!
E no finish for dat one o. E come talk again say, we no go even pay any money from now till October 15. E say di company take dat one do happy independence for we Lagos taxi driver dem. Olorun Oba o!
Di state chairman no even talk finish wen all of us begin hail am. Come see as we clap, sing and dance for our garage dat Friday afternoon. Di state chairman shock to see old people like us begin dance Azonto and Zanku Zanku.
How we no go happy wen be say dis Uber and Bolt people been don collect all our passenger finish? Sote e get some day wey we no go see even one passenger carry.
And di kind money wey dem dey collect for passenger hand na “who send you come?”
Na im make all our union member don decide to go do tanksgiving.
We say if na church or mosque you dey go, go dia go do tanksgiving with your people.
Na now I go see weda na babalawo Idowu go carry im own family go do tanksgiving. Na im wahala be dat sha.
Tank God say my wife and pikin dem get church, and na dia I go follow dem go do my own tanksgiving dis Sunday.
Abeg, make all of una wey like me come join us on Sunday for di tanksgiving wey go shele for my wife church wey dey for Pen Cinema.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.