Last Saturday, go-slow no be small for Lagos. Anywia you enter, na go-slow. Di hole Lagos jus block patapata.
Na dat Saturday dem do election for Edo. And upon say plenty Edo people for Lagos travel go dia village for di election, go-slow still full ground. Nobody come sabi wetin cause di go-slow.
E come be like say na for Lagos dem dey do di election wey make motor come plenty for road like dat.
And di ting come affect we taxi driver for Lagos no be small. To say I know, dat day I for kukuma siddon for house or jus rest for our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Na im make, dat Saturday all our union member dem no see face to face. Everybody been dey sweat inside di go-slow, and no be all of us dey show face for garage on Sunday.
Na yesterday Monday everybody appear for garage. Come see di kind haha wey everybody jus dey hala becos of Edo election. Na one of our union member, Osas carry di hole ting for head.
As I jus drive enter garage dat yesterday morning, Osas run come meet me, e no even let me park my guonguoro well.
Osas open one big bottle of Alomo, e say make I follow shack. I tell am say shebi im sabi say I no dey drink Alomo. I ask am weda im don forgot My Usual.
Before I talk am finish sef, Osas don use phone call im beer parlour woman make e bring me 4 bottle of Odekun. Tori Olorun!
I ask Osas weda im wife don born. E say dis one no be matter of pikin or no pikin. E say weda I no hear wetin shele for Edo.
And na so Osas jus dey supply drink to all our union member dem wey enter garage dat yesterday morning. Before you open eye, shakis don full everywia for garage.
Osas come use phone call all im Edo broda dem wey be im nebor for Anifowoshe. E say make all of dem appear for our garage now, now, now. Olorun Oba o!
As di 5 Osas Edo broda dem jus land, tori come change. E come be like say dem put fire for our garage dat yesterday morning. Dem buy orisirisi drink scatter di hole garage. Even people wey dey pass for road, branch our garage come follow drink.
Osas open im taxi stereo and begin play dia Edo music very loud. Come see dance for garage. All Edo people wey live for Ikeja come out, begin shack and dance.
Small time, all of dem come form one line, with bottle of drink for everybody hand. Na so dem run enter town, as dem dey shout:
“Edo no be Lagos! Edo no be Lagos!! Edo no be Lagos!!!”
I come talk am for my mind say, na una sabi.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.