Even aboki sef don increase tariff

News Express |8th Sep 2020 | 1,420
Even aboki sef don increase tariff

Na wa for Lagos o. E be like say man go begin dey plan small, small to go back to village.

But tell me, wia for Naija easy?

Yesterday as I wake up, I no rush begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge. I say make I first look as road go be, weda or wedan’t riot go shele as dem been talk am everywia.

I been hear say dem go close down everyting – market o, petrol station o, shop o etc, etc.

Di close down dis time no be beos of Coro o, but becos of say oga patapata don increase tariff.

Me sef no first sabi wetin be tariff until one passenger wey I carry last week come tell me say na NEPA and petrol money be tariff. Shiooorr!

Dat morning NEPA no kukuma bring light make I look TV or hear for Radio wetin dey happen for town.

I come dey listen weda I go hear noise for dat our Abule Egba road, as e be say if anyting like dat wan happen, na area boy dem go first full for road before di real people come out.

I wear my short shokoto and jumper, plus including cap and facemask, waka go tanda for main road.

But I see say motor dey for road, and people sef dey waka normal. Dem no close anywia, even di petrol station wey dey for dat our Abule Egba bus stop open dat morning.

Na im I run go house, say make I wash my guonguoro keep, atlist if 10 o'clock a.m in di morning nack and noting still happen, I go chuk head put for road with my guonguoro, go dey do my taxi driver work.

As I reach house, I top oil and water, I enter and begin warm di engine.

After dat, I call my second woman pikin Funke make e call aboki, our customer, tocome sell water make I take wash my guonguoro body as I dey do every morning before I enter road.

Funke go come back, e say e meet all di aboki wey dey for area gather for one place. But Sule, our aboki customer, tell am say e dey come now now.

Small time na im Sule come meet me, e no carry anyting. I ask am why e no bring water come.

Sule say e wan come tell me first say money for water don increase, so e come find out weda or wedan’t I go gree buy for new price before e begin go fetch di water come.

I ask am how much be di new price. Sule say na only N150 dem add for one truck. Tori Olorun!

Shey N150 extra for one truck of water na only?Ordinary water to take wash and baf, no be water to drink o! Olorun Oba o!

Sule come tell me make I no vex, say no be im cause am. E say na becos dem don increase money for di place dem dey buy di water, as NEPA don increase dia money. And if dem use generator sef pump di water, petrol price don increase.

I tell Sule make e go bring di water come.

As di aboki dey go, I come dey talk am for my mind say, na im be say me sef go increase my guonguoro tariff today, today. And na passenger dem go suffer am. Yes ke!

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Tuesday, October 14, 2025 11:07 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025