Bose wan marry new wife for me

News Express |2nd Jun 2020 | 1,644
Bose wan marry new wife for me

I don dey do dis my taxi driver work tipe tipe, and I sabi everyting wey dey inside am.

Na di work I do take marry Bose, and Bose come born two woman pikin – Bisi and Funke – for me. Di two both of dem don take JAMB. If no be dis Coro matter, dem for don dey prepare to enter Uniservity.

Na di taxi driver work I dey take give my family food and order tings wey dem need.

Na di work I dey take pay for dis Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey I dey live with my family for Abule Egba.

Na di money I dey take maintain my guonguoro since before Biafra war. Na im make am dey sound like tear rubber and fly like jet fighter for expressway.

Na di work I dey do, use di money take “My Usual” and orisirisi pepper soup for Madam Shine Buka

wen my throat scratch me. Yes nau. Abi I no go settle mysef?

And na di work I dey do take settle all dose Lagos sisi dem wey no dey let di son of man rest – Sikiratu, Aisha, Jumoke, etc, etc., in dat order.

Upon all dis, I no dey take my family play. I no ever tink of to marry second wife, even dough e no be crime for my village for Ogbomoso to marry any number of wife wey you like.

Na im make I surprise wen my wife wake me up by 5 o’clock am in di morning yesterday. E say e get wetin e wan discus with me before I comot go our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I tell am say weda di meeting no fit hold for night wen I come back, my wife say No. E say I go don tire wen I come back for night.

I tell am okay make e fire on.

Bose first talk say e sorry as e no dey do all di ting e suppose to dey do as my wife, make I understand say e don dey old, and woman body no be like man body.

I tell Bose say make e go straight to di point and stop dis corner corner talk. I ask am na wetin be dat ting wey e suppose to dey do for me wey e no dey do.

Bose say I no be small pikin wey go dey ask dat kind question. E say make I remember for night wen I wan touch am for bed but e shift comot.

Bose come talk say in short, to bring peace come for dis house and to make me happy, e wan marry new wife for me.

I come talk am for my mind say my wife Bose? Marry anoder wife for me? Abi I no hear am well?

Afraid come catch me. Tori Olorun!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

American missionary disgraces Reno Omokri

American missionary disgraces Reno Omokri

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Why soldiers are yet to get their allowances — Defence Headquarters

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

Confusion in court as woman slumps after husband insists on divorce

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

MRA blows hot as INEC demands N1.5bn to produce Voters Register and list of polling units in Nigeria

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Police, NBA set up committee to review tinted permit regulations

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Electoral Act Amendment: Akpabio decries alleged injustice in 2019 elections

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

Herbert Macaulay’s descendants reject group pardon, tell Tinubu to honour him separately

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

We have uncovered plot to destabilise our party — Imo ADC

JOA 2025: Fear of the unknown

JOA 2025: Fear of the unknown

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Ondo: Army vows expedited discipline of soldier involved in commercial driver’s death

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

Mama Rainbow celebrates 83rd birthday, 60 years on stage

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

US Senator Ted Cruz urges congress to pass Nigeria religious freedom accountability act

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Just in: Rivers cancels N134 bn contract awarded by Ibas, orders refund

Senate steps down electoral bill for more consultations

Senate steps down electoral bill for more consultations

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

I never represented Tinubu at 2023 presidential election petitions court — Amupitan

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Defections in Bayelsa are motivated by stomach infrastructure — Civil liberties organisation chairman

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

Chamber of Commerce, NDDC release N1.5B to boost businesses in Niger Delta

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

As billionaire wealth soars $33 trillion, Mark Cuban says it’s time for workers to receive a cut of their employers’ success in the form of stocks

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

NCAA, Orji Kalu in war of words over pilots’ competence, drug allegations

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Motorists jubilate as Customs sells intercepted petrol at N600/litre in Ibadan

Thursday, October 16, 2025 5:00 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025